Lauren James

From Wikipedia
Lauren James
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromUK Chenj-am
Country for sportEngland Chenj-am
Fest nemLauren Chenj-am
Famili nemJames Chenj-am
Wen dem bon am29 September 2001 Chenj-am
Ples wey dem bon amLondon Chenj-am
Broda an sistaReece James Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialityforward, midfielder Chenj-am
Wie e go skulTwickenham Academy Chenj-am
Member of sports teamArsenal F. C., Manchester United W.F.C. Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am

Lauren Elizabeth James (dem bon am on 29 September 2001) na English profeshonal futbola wey dey pley front for Women's Supa League klub Chealsea an di England Women's Nashonal teem.

Hau e stat life an skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Lauren James on 29 September 2001 in London. Shi get Grenadian an Domican blood fom im papa, an English blood fom im mama.

Na Whitton Skul wey dey Whitton, na im shi tek go skul.

Im klub wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Arsenal

Na Arsenal dikova James web shi dey 13 years old. On 29 October 2017, James pley fes match for Arsenal, shi enta 67th minutes, na Lisa Evans shi enta for insaid 2 - 0 match win wit Everton in 2017 - 18 season. Na shi bi di sekond playa wey smol for age wey go pley for Arsenal.

Manchester United

On 13 July 2018, dem tel pipu sey James go dey insaid playas wey go pley for Manchester United in di 2018 - 19 FA Women's Championship. Shi pley im fest match for Manchester United wen dem pley wit Liverpool on 19 August, na dem win di match 1 - 0.

Chelsea

On 23 July 2021, James sign four years kontrat wit Chelsea. Shi skore im fest goal for di klub insaid 9 - 0 win wit Leicester on 27 March 2022. Na shi win Young Playa of di Year Awod, bikos of hau shi tek pafom for 2022 - 23 season. In June 2023, James sign kontrat wey go mek am stil dey for Chealsea til 2027.

Kontri wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Youth

In April 2017, James pley im fest onda - 17 match insaid 2 - 0 win wit USA. On 14 October 2017, shi kaptain England for 10 - 0 win wit Lativa as pat of d i2018 UEFA Women's Under - 17 Championship qualification, shi skore four goals.

In January 2019, dem kol James to kom pley for Under - 19 for di Algarve Tournament. In July 2019, James nem dey insaid England's teem for di 2019 UEFA Under- 19 championship in Scotland.

Sinior

In November 2020, Dem fest kol James for sinior nashonal teem kamp at St. George's Park.

James fest pley for sinior teem on 3 September 2022, wen shi enta for anoda playa for England in di 79th minute for 2023 Wod kup qualification match wit Austria.

Shi skore im fest internashonal goal on 16 February 2023 wen England win South Korea 4 - 0 insaid 2023 Arnold Clark Kup.

On 31 May 2023, James nem dey insaid playas wey go pley for di 2023 FIFA Women's Wod kup. Shi skore Di onli goal insaid England's 1-0 win ova Denmark in dia sekond Grup D match, shi kon stil skore 2 goals, three assist an a playa of di match parfomans wit China in dia final grup match. Insaid knock out stej for 2023 FIFA Women's Wod Kup, James Kolet Red kard bikos of roff pley wey e du Nigeria playa na dem leta win di match wit penalties.

Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Lauren na sista to Chelsea an England's difenda Reece James. Na dem bi di fest England broda an sista playas wey go pley for England sinior teem.

Shi tok sey na im papa e dey luk as ezampu for futbol. Im papa Nigel, na UEFA licensed refree.

Hau e tek wok for teble[chenj-am | chenj-am for orijin]

Klub

As of match wey e pley on 27 May 2023

Appearances and goals by club, season and competition
Club Season League Women's FA Cup|FA Cup FA Women's League Cup|League Cup Europe Total
Division Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals
Arsenal 2017–18 WSL 1 5 0 0 0 3 1 8 1
Manchester United W.F.C.|Manchester United 2018–19 Championship 18 14 3 2 6 1 27 17
2019–20 WSL 12 6 1 1 5 2 18 9
2020–21 WSL 10 2 0 0 1 0 11 2
Total 40 22 4 3 12 3 56 28
Chelsea F.C. Women|Chelsea 2021–22 WSL 6 1 3 0 2 0 1 0 12 1
2022–23 WSL 18 5 4 0 3 1 8 2 33 8
Total 24 6 7 0 5 1 9 2 45 9
Career total 69 28 11 3 20 5 9 2 109 38

Goals wey e don skore[chenj-am | chenj-am for orijin]

List of international goals scored by Lauren James
No. Date Venue Opponent Score Result Competition
1 16 February 2023 stadium MK, Milton Keynes, England KOR 4–0 4–0 2023 Arnold Clark Cup
2 28 July 2023 Sydney Football Stadium, Sydney, Australia 1–0 1–0 2023 FIFA Women's World Cup
3 1 August 2023 Hindmarsh Stadium, Adelaide, Australia 3–0 6–1 2023 FIFA Women's World Cup
4 4–1

Honors[chenj-am | chenj-am for orijin]

Manchester United

  • FA Women's Championship: 2018–19 FA Women's Championship|2018–19

Chelsea

England

Individual

  • London Football Awards Women’s Young Player of the Year: 2023.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]