Laura Boulton

From Wikipedia

Laura Boulton (dem bon am January 4, 1899 an e kpai October 16, 1980) na Amerika pesin wey dey stodi how difren kolsho dey sing. Pipul sabi am wel wel bikos of e rekodin, fims, fotografi of tradishonal muzik an e paformans in Egypt, Sudan, Uganda, Kenya an Tanganyika. Boulton dey kolet eni tradishonal instrumet wey e si araund di wold an dey kip am.Bikos of di work wey e du wit Nashonal Fim Board of Kanada, Pipul biliv sey Boulton dey among di fest wuman-dem wey wok for fim indostrie.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Konneaut, Ohio dey bon Laura Theresa Crayton on January 4, 1899. Boulton go rid how pesin dey tok an kolet e BA satifiket in Denison Yunivasiti. Boulton mari Rudyerd Boulton in 1925. Rudyerd Boulton na pesin wey dey stodi bird an leshura for Carnegie Museums of Pittsburgh wey de Pittsburgh. E bi one of di staff in di eli 1920s.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Boulton stat e Masta an Ph.D digri at di Yunivasiti of Shikago in 1929. E de di dipatmet of "anthropology". For January 1929, Boulton stat e fest risach travul. Boulton join or lid risach travul group for ova 50 years of e life aa e dey yuz e rekod tape to rekod tradishonal song an bird song. Di travul wey Boulton an e group du wit di hep of Amerika Musium of Nashoral Histri wey last for three months mek Boulton fit kolet an kip muzikal instrumet an rekod vois from Egypt, Sudan, Uganda, Kenya an Tanganyika Ova di nes 50 years, Boulton join in meni intanashonal travul, koletin rekod, fims an muzikal instrumet. Di buk wey Boulton rait wey tok abaut e life "The Music Hunter" tok abaut e travul an oda informashon. From di buk, Boulton tok sey wetin e want from e wok na to bring bak di wold muzik, no bi di one wey we de lisin to for studio or muzik house but di muzik of di pipul. Di kontrie wey Boulton stil go an kolet muzikal informashon an instrumet bi: Mozambique, Nyasaland, Rhodesia, Transvaal, Cape Province, Sierra Leone, Liberia, Angola, Naija, Senegal, di Koloni of Niger, Dahomey an odas oda pat of French Equatorial Afrika, di Kameroon, di Belgian Congo, Ethiopia di Ghana.