Dahomey

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Dahomey na one bifor bifor kindom for West Afrika wey dey for di ples wey pipul don dey kol Benin now araud 1600-1904. Dahomey stat to gro on top Abomey land amog di Fon pipul for eli pat of 17 senturi an kon ton to aria wey get pawa for 18 senturi as dem dey mek di south big wel wel so dat dem go fit win big-big siti-dem like Whydah for Whydah kingdom wey dey for Atlantic aria an dis tin kom giv am shans to tek enta difren-difren bizness for di kontinet. In d 19 senturi, Dahomey Kingdom ton to veri impotant Stet Afta wey dey stop to dey du boi-boi for Oyo Empaya.Las-las Oyibo pipul-dem fom Europe kom rait plenti-plenti tins about di Kingdom an Dahomey kom ton to one of di Kindom-dem for Afrika wey Oyibo pipul for Europe no wel-wel. Dahomey na one impotant kingdom wey dey gro with di moni wey kol fom dis fight fight an dia slave Bizness.Dahomey get artwok, an one Armi wey bi sey na onli wuman ful di Armi an dey like to du one riligion akt wey bi Vodun. As Dahomey empaya dey gro,na so slave bizness sef dey gro for Atlantic aria, as tins dey chenj kom mek Oyibo pipul dem no Dahomey as kindom wey dey soplai Slave pas.Wen Dahomey kindom Dem go for war an to fight dey Dem tek pipul wey dem win as slave, an Oyibo pipul go kolet dem from Dahomey pipul an yuz guns, gun pawda, kories, siga, an ogogoro as moni to pai dem. Di oda slave wey Oyibo no gree kolet go dey du slave for Dahomey. Dey fit dey wok for king farm or dey fit yuz dem as sakrifa for díá oraku.

For 1840s, Dahomey pawa stat to dey wik smol smol bikos Oyibo dem no wan dey kolet slave again an Oyibo dey mek suo sey di bizness of slave no go again.Anoda tin wey wik Dahomey kindom bi di fight wey happun bitwin Dem an Abeokuta wey dey onda Oyo Empaya. Dahomey Solja no win day fight. Dahomey Empaya kom stat to get wahala wit France ova win díá land rish an dis one korse di Fest Franco-Dahomey War for 1890 an na France win for date war.Di Dahomey kindom fanali skata in 1894 wen di France solja win di last king of Dahomey Béhanzin for di sekod Franco-Dahomey War an dis mek France Govament join di land of Dahomey to di land wey dey kontrol as French West Afrika .Leta, France kom giv Dahomey indipendet in 1958.