Khabirat Kafidipe

From Wikipedia
Khabirat Kafidipe
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejKhabirat Kafidipe Chenj-am
Orijina nemKhabirat Kafidipe Chenj-am
Wen dem bon am29 July 1980 Chenj-am
Ples wey dem bon amAbeokuta Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor, producer, director Chenj-am
Wie e go skulOlabisi Onabanjo University, Abeokuta Grammar School Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Kabirah Kafidipe (dem bon am for July 29, 1980) na Naija fim aktress, dareto an podusa. Pipul no am wel wel as “Araparegangan” as e akt inside Saworoide, a 1999 Naijá fim wey Tunde Kelani mek an daret.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kafidipe wey dem bon July 29, 1980 kom fom Ikereku, Abeokuta Ogun Stet, Southwestern Naijá. Shi go Abeokuta Grammar School for im sekondiri skul bifor e go rid Mass Communication for Olabisi Onabanjo University.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di fest fim wey Kabirah akt inside na The White Handkerchief.Di fim na smol fim inside one buk The Virgin wey Bayo Adebowale fest rite.Na Tunde Kelani bi di podusa an Dareto of di fim.Pipul stat to no e nem wel wel afta Kabirah du Saworoide wey Tunde Kelani mek an podus.Saworoide na 1999 Naijá fim wey Kunle Afolayan, Peter Fatomilola, Kola Oyewo, Yemi Shodimu dey inside. Kabirat leta akt inside one 2004 Naijá fim, wey di nem na The Campus Queen. Im dey inside The Narrow Path, a 2006 fim wey Sola Asedeko, Beautiful Nubia akt inside an na Tunde Kelani du di fim for Mainframe Films and Television Productions.Di pat wey e akt for Iwalewa mek Kabirat win one awod for di Africa Movie Academy Awards as di Best Aktress in a lidin Rol in 2006. Kabirat akt inside .Shi Dazzling Mirage, a 2014 Naijá drama fim, wey Tunde Kelani podus an daret an Kunle Afolayan, Bimbo Manuel, Yomi Fash Lanso, Taiwo Ajai Lycett also dey inside di fim.Kabirat mek one fim wey get di nem Bintu an dey fest sho di fim for R & A Hotel at Opebi in Ikeja, Lagos Stet.