Jumoke George
Industry | film industry, cinema of Nigeria ![]() |
---|---|
Man abi wuman | wuman ![]() |
Kontri wey e kom from | Naija ![]() |
Nem for lokal langwej | Jumoke George ![]() |
Orijina nem | Olajumoke Amoke Olatunde George, Jumoke George ![]() |
Fest nem | Jumoke ![]() |
Famili nem | George ![]() |
Ples wey dem bon am | Naija ![]() |
Fest langwej | Yoruba Langwej ![]() |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej, French ![]() |
Wok wey e dey du | actor ![]() |
Pat of wok wey e put mind | theater arts ![]() |
Rilijon | Christianity ![]() |
Eye kolor | brown ![]() |
Hair kolor | black hair ![]() |
Filmography | Love Castle, The ghost and the tout, My Wife & I, The Wedding Party ![]() |
Awod wey e kolet | City People Entertainment Awards ![]() |
Personal pronoun | L485, L484 ![]() |
Jumoke George (Olajumoke Amoke Olatunde George) na Naijá wuman wey dey akt fim an de mek fim. Jumoke dey akt for yoruba an Inglish langwej fim in Nollywood an shi dey also du Televison sho in Naijá.
How e tek stat life an go Skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Jumoke George on February 18, an na for Ibadan, in Oyo stet. Im papa bin souja fo Naijá an im stepmama na norse wey don wok for hami. George papa an mama marej skata wen shi di smol pikin, an na George papa an e stepmama tekia of am. Wen George get katakata wit im stepmama, George papa poshuu am komot for hause an dat time e dey Sekondiri Skul. George kon dé wit im frend. George go Command Children School Ann's barak Yaba, Legos; Army Children School Kano; Anglican Gramma Skool Oríta mefa, Ibadan.George go Gofment Teknikal kolege Osogbo go rid Business Administration.
How e tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Wen George bi 8 years old, one famili frend hep am stat to dey du Aktin. Shi do aktin for stage wit NTA ( National Television Authority), Ibadan. Shi enta a drama klass for Ibadan wen Victor Ashaolu pay for. Jumoke kom stat to dey akt Yoruba fim. Wen aktin bi laik se no shoo, George kom bi memba of FIBAN (Freelance and Independent Broadcasters Association of Nigeria). Jumoke don bi di tok tok pesin for Fauve live shoo an dis one de mek am bizi wen shi no de akt.
Awod
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 2018, Citi Pipul Movee giv am Matriarch Recognition Awod.
Fim wey Jumoke don akt insaid
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Eekan soso, 2009.
- The wedding party, 2016.
- My Wife & I, 2017.
- The Ghost and the Tout, 2018.
- Love Castle, 2021.