Iyabo Ojo

From Wikipedia
Iyabo Ojo
pesin
Industryfilm industry, cinema of Nigeria, entertainment industry Chenj-am
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejAlice Iyabo Ojo Chenj-am
Orijina nemAlice Iyabo Ogunro Chenj-am
Fest nemIyabo Chenj-am
Famili nemOjo Chenj-am
Wen dem bon am21 December 1977 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
PapaAdekunle Ogunro Chenj-am
MamaOlubunmi Fetuga Chenj-am
Broda an sistaBabalola Ojo Chenj-am
Pesin wey e mariPaulo Chenj-am
PikinPriscilla Ojo Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor, film producer, film director Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtheater arts Chenj-am
Wie e go skulLagos State University of Science and Technology Chenj-am
Academic degreeBachelor in Business Administration Chenj-am
Academic majorEstate management Chenj-am
Wie e dey livLekki Chenj-am
Wen e stat wok1998 Chenj-am
E pipulYoruba Langwej Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
FilmographyThe Real Housewives of Lagos, Divorce Not Allowed, Under the Carpet Chenj-am
Awod wey e koletBest of Nollywood Awards Chenj-am
Nominated forBest of Nollywood Awards Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Alice Iyabo Ojo (dem bon am December 21, 1977) na Naija fim aktress, dareto an produsa. Shi don du pas 150 fims an produs more dan 14 fim-dem.

How e stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Iyabo Ojo wey pipul no as Alice Iyabo Ogunro wey dem bon am for Decemba 21, 1977 for Legos Stet, Naija, Iyabo Ojo papa kom from Abeokuta,Ogun stet. Na shi smol pas inside di three pikin wey ha papa bon an shi kon get two sinior boda for front.Shi go skul for Legos Nashonal kolej Gbagada, bifor shi Kon go stodi Estet Manejment for Legos Stet Politeknik.

Karier[chenj-am | chenj-am for orijin]

Iyabo Ojo don join drama skul since shi Don dey sekondri skul, shi stat her Aktin karier for 1998. Shi rejista wit di Aktor Guild of Nigeria (AGN), na Bimbo Akintola an som oda pipul hep ha for di rejista.

Ojo don write an akt for plenti Naija fim. Ha fest pley na for 1998's Satanic na inglish languaj fim. For 2002, shi du ha fest Yoruba languaj fim wey bi Baba Darijiwon. For January 2015, ha fim Silence wey shi fishure Josef Benjamin Alex Usifo, Fatia Balogun, an Doris Simon, wey dem show for silvabed sinimas, Ikeja for Legos.

For 2004 Ojo stat dey produs ha fims by ha sef. Ha fest fim na Boluwatife afta dat one shi kon do Bofeboko, Ololufe, Esan an Okunkun Biribiri. Shi an ha hosband don fight bifor Shi popula.

Pasona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Shi mari a Legos bes klearin ajent for 1999, wen shi dey 21 years , Iyabo no Kom rest smol for aktin. Shi Kom bon one son an one dota (shi bon for 1999 an 2001) wey their nem na Felix Ojo an Priscilla Ajoke Ojo, bot Iyabo an their papa no dey togeda again. Shi tok set na bikos sey shi too smol wen shi mari na why di marej skata. Shi kon stil tok say Shi no go dey use ha bifor bifor hosband nem, wey bi Ojo.

Pinkies Foundeshon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Iyabo Ojo opun ha NGO, Pinkies Foundeshon, wey dey sopot smol smol child wey nid hep an speshial pikin dem, in May 2011. Shi selibret di fifth anivasri for di foundeshon for May 1, 2016 for R&A siti hotel,Ikeja,Legos.

Activism[chenj-am | chenj-am for orijin]

For April, 2021, Shi kondem anoda aktor wet bi Yomi Fabiyi bikos im dey piti Olanrewaju Omikunle(Baba ijesha) wey polis arest bikos im molest one smol pikin for may 12, 2021.shi kon tek legal action egenst Yomi Fabiyi ( wey donn dey fait sey mek dem rilis Baba ijesha) sey Iyabo don use mouth dey spoil di man. DIS tin wey Iyabo du no mek everibodi for Theatre Art and Motion Pictures Practitioner Association of Nigeria (TAMPAN) hapi so tey dem tok sey mek nobodi kol am for fim for Jun 28, 2021. Aktor Jide Kosoko tok dis one insaid legit.ng di time wey im dey reprisent TAMPAN sey Noliwood fimmeka unda di asosiashon go stop to dey wok wit ha.

E no tey wey dem komot dis ban for ha hed bikos shi beg dem.

Som fim wey shi du[chenj-am | chenj-am for orijin]

Satanic(1998)

Agogo Ide (1998)

Baba Darijiwon (2002)

Okonla (2013)

Silence (2015)

Beyond Disability (2015)

Black Val

Arinzo

Apo Owo

Awusa (2016)

Tori Ife(Love)

Trust (2016)

Ore (2016)

Ipadabo (2016)

Twisted Twin (2016)

Kostrobu (2017)

Gone to America (2017)

Divorce Not Allowed (2018)

The Real Housewives Of Lagos (2022)

Awods an Nomineshon[chenj-am | chenj-am for orijin]