Ike Ekweremadu

From Wikipedia
Ike Ekweremadu
pesin
Part ofNigerian senators of the 9th National Assembly, Nigerian senators of the 8th National Assembly, Nigerian senators of the 7th National Assembly, Nigerian senators of the 6th National Assembly Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejIke Ekweremadu Chenj-am
Orijina nemIke Ekweremadu Chenj-am
Fest nemIke Chenj-am
Wen dem bon am12 May 1962 Chenj-am
Ples wey dem bon amEnugu State Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Nigeria, University of Abuja Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
Eye kolordark brown Chenj-am
Educational stageDoctor of Philosophy Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Ike Ekweremadu (bon 12 May 1962) na Naija politishian an lawya wey kom fom Enugu State an sarf in di Senate of Nigeria for Enugu West fom 3 June 2003 rich 5 May 2023. Na people's Democratic Party memba, an na bifor bifor Deputy President of the Nigeria Senate 3 times (6th 7th an 8th) Senate. On 23 June 2022, Ekweremadu an im wife get case for insaid UK bikos dem tok sey e wan kari one 21 years old pikin enta UK to komot som pat for im bodi[1] . Dem leta jorg im kase on 23 March 2023 for Old Bailey, sey na tru sey e get hand insaid di Matta. On May 5 2023, di kourt komfam am sey mek e go prison for Nine years and eight month.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ike Ekweremadu at Amachara Mpu in Aninri Lokal Govment Aria of Enugu Stet, an na Igbo pesin, E get Bachelor's an Master's degree of in law fom di University of Nigeria, an dey kol am to Nigeria Bar in 1987. E get Doctor of Philosophy degree in law fom di University of Abuja, Nigeria.

Politikal ofis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na im bi di Executive Chairman of Aninri Lokal Govment Council onda United Nigeria Congress Party (UNCP) in 1997, an win bes Council chairman for dat year.

Senatorial karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

On 12 April 2003, e enta as Naija Senate. In September 2003, as Vice Chairman of di Senate Committee on Informashion, e tok sey dem go du investigashon ontop money wey dem bifor bifor Federal Capital Territory (FCT) minista Mallam Nasir el-Rufai Kolet for bak wey no rekod am. Ike Ekweremadu an Nasir El-Rufai no dey tu klose, an dey kon cherj El-Rufai wit koropshion kase insaid 2008. In 2005, Ike Ekweremadu no win di Senate President of Nigeria wey e plan to enta, na Senator Kenechukwu Nnamani win am.

In July 2006, as tok tok pesin for di Southern Senators' Forum, e let pipu no sey na lie sey dem don get agrimet to Kari pawa go North insaid 2007 elevation. In September 2006, President Olusegun Obasanjo tel di Senate sey mek dem chek di repot wey Economic and Financial Crime Commission (EFCC) giv on top moni wey dem tok sey forma Vice President Atiku Abubakar no uze wel. Ike Ekweremadu kon tok sey dem go arenj committee wey go luk insaid di matta, but tok sey to komot am go had bikos na 2/3 majority sopot fit komot am.

Ekweremadu kom bak in di 29 April 2007 Nigeria National Assembly elecshion, an na im enta as deputy senate president. Na im dem giv pawa to dey selet committee chairman wey dey for Southeast. In July 2007, Ekweremadu get hand insaid hau Ojo Maduekwe tek get minister posishon.

Wen President Umaru Musa Yar'Adua's pasonal Secretary, David Edevbie, get som wahala for British bikos dem tok sey e pak moni wey bi for govment in September 2009. Ekweremadu no gree let pipu no weda e dey sopot am or e no sopot, e jus tok sey e no sabi di koko of di matta. In September 2009, Na Ekweremadu dey insaid chairman wey go du primary eleshon for di People Democratic Party's governor's candidate for Anambra state.

Senatorial elecshion 2011[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Ike Ekweremadu enta as Senator for Enugu West in di April 2011 elecshions, e get 112,806 votes. Pesin wey folo am na People for Democratic Change candidate (PDC), Jackson Ezeoffor, wey get 7,522 votes.

Senatorial elecshion 2019[chenj-am | chenj-am for orijin]

On 23 February 2019, na Ekweremadu enta as senate for Enugu West for di fifth time wit 86,088 votes. Pesin wey folo am na Mrs Juliet Ibekaku Nwagwu of di All Progressives Congress (APC) wey get 15,187 votes.

On 11 June 2019, Ekweremadu no enta as Deputy Senate President of di 9th Senate. Na Ovie Omo-Agege wey get 68 votes enta. Ike Ekweremadu don tok sey e no go for Nigeria Senate in 2023.

ECOWAS[chenj-am | chenj-am for orijin]

In September 2009, e dey insaid di pipu wey Economic Community of West African States (ECOWAS) as hoc selet to wok on hau dem go dey folo lor wey Niger Republic get. Na im bi Di fest Deputy Speaker of di ECOWAS parliament an leta bi Speaker for parliament in August 2011.

Katakata wey hapun for Nuremberg, Germany[chenj-am | chenj-am for orijin]

On 17 August 2019, wen Ekweremadu go sekond Cultural Festival and Convention wey Ndi-Igbo du for Nuremberg, Germany. Indigenous Peoples of Biafra (IPOB) korse katakata for dia, dem tok sey Ekweremadu no tok wen govment dey kill Igbo pipu wit di Operations Crocodile Smile an Phyton Dance wey Army dey du for South. Dem troway tins for Ekweremadu bodi, na dat one mek am komot for di ples wey dem dey du Di festival, som tok sey e get wound sef. IPOB oga, Nnamdi Kanu tok sey di tins wey hapun to Ekweremadu na jus to draw dia ear, sey if dem no go stil du di sem tin for som Igbo govonors. Dem karch four pipul wey folo du di katakata an dem giv dem 20 days of wok for govment bikos dem korse katakata ontop pesin.

2022 UK Bodi Pat kase[chenj-am | chenj-am for orijin]

On 23 June 2023, dem kari Ekweremadu an im wif, pikin an Dr Obinna Obeta go kourt bikos dem gada aren't to kari one 21 years old boy go UK fom Legos to komot im Pat of Bodi. On 23 March 2023, Ekweremadu, im wif an Dr Obinna Obeta kourt tok sey na tru sey dem wan komot di boy bodi pat. Pesin wey kari dem go kourt tok sey na 2022 dem kari di boy kom UK to kom komot im Kidney for €80,000 insaid Royal Free Hospital, London. Pesin wey kari dem go kourt stil tok sey na €7,000.an wok for UK dem promis go giv di boy. Dem wan komot am giv dia pikin wey bi girl -wey dem leta sey di girl no no abuat am. On May 5 2023, kourt tell Ekweremadu go uze nine years an eight month for prison. Obeta go uze ten years for prison an Ekweremadu wif go uze four years an six month for prison. On August 2022, dem komfirm am sey Ekweremadu dey HM Prison Wandsworth, Dr Obeta dey HM Prison Belmarsh. Ekweremadu wif dey HM Prison Bronzefield.

Awods an honors[chenj-am | chenj-am for orijin]

CFR, Knight of the Good Shepherd, Ikeoha, Ndigbo

Rotary Club Outstanding Citizen of the world 2017

Dr Kwame Nkurumah Africa Leadership Award.(2005).[1]


Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Sufuyan Ojeifo (12 May 2014). "Ekweremadu: Praxis of persistent, consistent loyalty". Vanguard.