Hushpuppi

From Wikipedia
Hushpuppi
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Orijina nemRamon Olorunwa Abbas Chenj-am
Fest nemRamon Chenj-am
Famili nemAbbas Chenj-am
Wen dem bon am11 October 1983 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos State Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Convicted ofextortion Chenj-am
Wok wey e dey duInstagrammer, blogger Chenj-am
Wie e dey livNaija, Lagos Chenj-am
Eye kolorblack Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Interested inreal property Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Ramon Olorunwa Abbas ( dey bon am 11 October 1982) wey pipo no wel wel as Hushpuppi, Hush, or Ray Hushpuppi na Naija pesin wey like to dey sho-kes wetin e get for sosha midiha like Instagram. Hushpuppi na kriminal wey United Stet give 11 years in prisin. Di kot tok sey Hushpuppi dey do yahoo-yahoo, e yuz wayo kolet moni wey go rish 40 million dorlas from one US law kompini, e yuz wayo transfa $14.7 million from one bank akaunt, an sey e dey plan to thif $124 million from one English Premier League Klub.

Bifor Dubai Polis kach Hushpuppi an hand-ova am give United Stet, Hushpuppi dey post piksho an vidio of how e dey spent moni. Di vidio an piksho dey show e motor, e bag, e disaina klot. Hushpuppi dey show wetin e buy from Gucci, Fendi, an Louis Vuitton. E vidio an pisho stil dey show how e de inside helikopta, with pipo wey get nem, with futbola, an Naija politishan.

Hushpuppi tok sey e wok na kontrator wey dey supavais estate. Hushpuppi get St Kitts and Nevis visa bikos of one wayo marej wey e tek mari one wuman wey kom from St Kitts and Nevis.

Di night wey dey harest Hushpuppi for di Palazzo Versace Dubai wey e dey stey, Di polis si moni wey pass 150 million dirham ( na like $40 million) for e poket, 13 big motor wey go rish $7 million, 21 laptop, 47 big fone, 15 memori kard, an email of 800,000 pipo an one bag kase wey moni full am.

Na one investigeshon wey oyinbo polis FBI na e lid to Hushpuppi harest bikos di investigeshon show sey e de among di pipo wey dey put hand for moni wey dey thif yuzin intanet.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Meni niuz-pepa tok sey na sekod-hand klot (okirika) Hushpuppi dey sel for Legos. Hushpuppi dey tok about di time wey e smol wey e no get moni. Mompha, one pesin wey dey helep pipo chenj oyinbo moni for Naija tok sey Hushpuppi papa still dey yuz motor kari pipo for road in Legos. Wen one Naija niuz-pepa kol The Cable intavihu one of Hushpuppi neibor, di neibor tok sey meni pipo for aria don no Hushpuppi as Yahoo boys an sey Hushpuppi no yuz e moni helep eni of e famili. Di neibor tok sey Hushpuppi no yuz e moni helep eni of e frend an sey, wen pipo dey warm am abaut e life patta, e no hear lisin.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]