Jump to content

Herbert Wigwe

From Wikipedia
Herbert Wigwe
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejHerbert Wigwe Chenj-am
Orijina nemHerbert Onyewumbu Wigwe Chenj-am
Fest nemHerbert Chenj-am
Famili nemWigwe Chenj-am
Wen dem bon am15 August 1966 Chenj-am
Ples wey dem bon amIbadan, Isiokpo Chenj-am
Wen e kpai9 February 2024 Chenj-am
Place of deathNipton Chenj-am
Manner of deathaccidental death Chenj-am
Cause of deathhelicopter crash Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dueconomist, banker Chenj-am
Wie e go skulUniversity of London, University of Nigeria Chenj-am
AffiliationAccess Bank Chenj-am
Affiliation stringAccess Bank Plc Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Participant inWorld Economic Forum Annual Meeting 2015, World Economic Forum Annual Meeting 2017 Chenj-am
Awod wey e koletOrder of the Federal Republic Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Herbert Onyewumbu Wigwe CFR (15 August 1966 – 9 February 2024) na Naija banka an biznesman. Na im bi manaji dairekto an CEO of Access Bank Plc, wey bi one of Naija big bankin institushon.

Wigwe stat wok for Coopers & Lybrand an Guaranty Trust Bank bifor e join Access Bank in 2002 as di deputy Managin dairekto. E kon bi chief exekutiv ofisa of di kompini in January 2014. E kpai insaid helicopter wey skata on 9 February 2024 insaid United States wen e dey go ci Sunday's Super Bowl LVIII championship in Las Vegas.

How e tek stat life an edukashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Herbert Wigwe on 15 August 1966, insaid Ibadan, Oyo State, Nigeria.[1] Im papa na di diarekto general of wey klose wit di head of di Nigerian Television Authority an im mama na Nurse.

Wigwe stat im edukashon insaid Ibadan, leta kon muv go Federal Government College (FGC) Sokoto, an leta to FGC, Warri, Delta Stet, wia e tek finish im sekondri edukashon in 1982. In 1987, Dem giv am bachelor digre in accountancy fom di University of Nigeria, Nsukka.

In 1990, Wigwe kolet di British council scholarship wey go mek am stodi for Universiti College of North Wales (nau Bangor University), wia e tek get Masta of Arts in bankin an finance in 1991.[2] E leta kolet Msc in financial ekonomiks fom di University of London in 1996. E go Havard Business Skul exekutiv management program, an in 2018 e kolet honorary doctorate fom di University of Nigeria, Nsukka.

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wigwe stat im wok for Coopers & Lybrand as a management konsoltant in di late 1980's, wey mek am bi chartered akountant in 1989. E leta join Guaranty Trust Bank, wia e tek wok for plenti years wey mek am rish exekutiv diarekto insaid 1998.

Im pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wigwe mari fom 1994 to Doreen Chizoba Wigwe (nee Nwuba), wey dem bon on 12 July 1967, an e get five pikin.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Wigwe win Banker of di year awod wey Sun an Vanguard, wey bi Naija top Niuspepa du.

Di kain koret an fain ezampu wey e dey sho mek dem giv am Stet Patron for Lagos State Council in 2016. In October 2022, kommander of di Fediral Repoblik, wey bi Naija nashonal honor, Dem giv am onda President Muhammadu Buhari.

Wia dem gada tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. "Obituary: Herbert Wigwe Financial Expert who transformed small bank to global institution". The Cable Nigeria. Retrieved 1 April 2024.
  2. Oluwole, Victor (10 February 2024). "Hebert Wigwe: Life in pictures". Business Insider Africa (in Ínglish). Archived from the original on 16 February 2024. Retrieved 11 February 2024.