Hadiza Bala Usman

From Wikipedia
Hadiza Bala Usman
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Wen dem bon am2 January 1976 Chenj-am
Ples wey dem bon amKaduna State Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Wie e go skulAhmadu Bello University Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am

Hadiza Bala Usman (dey bon am 2 January 1972) na Naija politishan an di oga patapata (manijin daretor) of Nigerian Port Authority from 2016 go rish 2021. Hadiza don bi Shiff of Staff to di govno of Kaduna Stet from 2015 go rish 2016. Hadiza join bodi form di bring Back Our Girls kampain. E stil bi fondin memba of APC ( All Progresive Parti).

How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 2 January 1976 dey bon Hadiza Bala Usman in Zaria . Hadiza famili na Fulani wey get pawa wel wel an dem bi Sullubawa tribe. Yusufu Bala Usman wey bi Hadiza papa na leshura an pesin wey dey rait Histri wey dem no wel wel for Zaria. Na Hadiza papa form di "Sental for Demokratik Divelopmet, Risach an Trainin" wey de Zaria. Hadiza great gra-pa ( from e mama side) bi Abdullahi Bayero wey bi di nomba 10 Emir of Kano from 1926 go rish 1953. Hadiza gra-pa ( from e fada side) bi di Durbin Kastina an e onku Usman Nagogo bi di Emir of Kastina Hadiza gro up inside Ahmadu Bello Yunivasiti Kampos in Zaria bikos e papa na leshoral for di Yunivasiti.Hadiza go di Yunivasiti Staff Pamari Skul. Hadiza stil finish e sekondiri edukeshon for Zaria Hadiza enta di Yunivasiti in 1996 to rid Bizness Administrashon an e finish e B.Sc in 2000. Hadiza go Yunivasiti of Leed to do e masta digree an e finish am in 2009.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • 1999

Hadiza yuz one year tek wok for di Demokratik Divelopmet an Risach Divelopmet an Risach Trenin wey de Zaria as Risach Hasistant.

  • 2000-2004

Hadiza wok as Entaprasis Ofisa for Bureau of Poblik Entaprasis from July 2000 go rish August 2004.

  • 2004-2008

Hadiza wok for UNDP for di Fediral Kapital Teritiri Hadiminitrashon as speshal Hasistant to di Minista of Projet Impimenteshon from October 2004 go rish January 2008.

  • 2011

Hadiza kampain to repriset Musawa/Matuzu for Fediral Konstituensi. E yuz CPC (Congress for Progressive Change/Kongress for Progresive Chenj tek kampain but e no win for di eleshon.

  • 2011-2015

Hadiza join Good Governance Group/Gud Governance Group in Naija, one organasashon wey govamet no dey chuk mouth inside. E wok as dia Daretor of Strateji from 2011 go rish July 2015. Wen Boko Haram kidnap Chikbok skul gel-dem in 2014, Hadiza join bodi tek form di Group "Bring Back our Girl" to fit force di govamet to do sometin abaut di mata. Hadiza helep arrenj how govamet an di peret of dos pikin go fit dey tok.

  • 2015

Wen Nasir Ahmad el-Rufai bikom di govno of Kaduna Stet, E pik Hadiza as di Shiff of Staff of Kaduna Stet.

  • 2016

Forma presidet Muhammadu Buhari chuz Hadiza as di Manijin Daretor of NPA Nigerian Ports Authority in July 2006. Meni pipo tok bad abaut dis bikos dey sey Buhari yuz am fevor e tribe an sey Hadiza no get di sense to fit do di wok.

  • 2021

Buhari suspend Hadaza mek e no wok as Manijin Daretor of NPA.

Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Hadiza na di wife of Tanimu Yakubu Kurfi. E hosband bi di pesin wey dey stodi ekonomik wey wok onda Naija presidor wey kpai Umaru Musa Yar'adua. Di marej bring two boi-pikin

Awod[chenj-am | chenj-am for orijin]

Meni pipo tok beta tins abaut e wok for NPA. Hadiza kolet awod as fimeli wey try pass for exekutiv in Poblik Sarvis (Maritime) in 2021.