Jump to content

Gani Adams

From Wikipedia
Gani Adams
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemAbiodun Chenj-am
Famili nemAdams Chenj-am
Wen dem bon am30 April 1970 Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokYoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, social activist Chenj-am
Wie e go skulLagos State University Chenj-am
Wen e stat wok1992 Chenj-am
Organization directed by the office or positionOodua Peoples Congress Chenj-am

Cheif Ganiyu Adams wey plenti pipu sabi as Gani Adams (wey dem bon for 30 April 1970), na Naija pesin wey like to fight for pipo right, politishan, pesin wey like tradishonal tins an di 15th Aare Ona kakanfo of Yorubaland.

How e tek stat life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem Gani Adams bon Gani Adams on April 30, 1970 for Arigidi-Akoko, wey dem sabi nau as Akoko north-west lokal govmet aria of Ondo Stet.

=How e tek go skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Gani Adams stat skul for Army children's school wey de Otukpo, Benue Stet. Di kain wok wey im papa dey du mek Gani Adams kom Legos, wia e kon go Municipal Primary School wey de Surulere aria of Legos Stet in 1980. Afta im primari skul edukashon, Gani Adams kon go Ansar-Ud-deen Secondry School wey de Randle Avenue, Surulere. Afta e finish sekondri edukeshon, e go len kapita (furniture) wok, wey e finish in 1987.

Hau e tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adams tink abaut wetin go giv am moni to buy hol di tins e want. E wok for Stabilinin Vissioni Limited, Italian kompini wey dey Apapa, Lagos. E wok for di kompini as pesin wey dey mek insaid tins fain. E leta stop di wok to go stat im own, wey e kol am "Gadson Interior".

Gani Adams don dey faight for pipu raight sins e dey smol. In 1992, e dey insaid pipu wey no wan mek military dey for pawa, e wan mek evribodi dey vote an dey put hand insaid hau di kontri dey selet leader.

Bikos as e tek dey faight for pipu, dem mek am Public Relations Officer of Mushin local government chapter of Civil Liberties Organization(CLO) in 1993; one grup wey dey faight for pipu raight in Nigeria. Na im stil dey insaid pipu wey stat Oodua Youth Movement (OYM) an statin member of the Oodua Peoples' Congress in 1994. Na im bi di fest Nashonal Deputy Coordinator an di niu Kordinato of Oodua Peoples Congress. Gani na bifor bifor leader of one pat of di Oodua People's Congress, one parti wey dey faight for Yoruba pipu.

On 14 October, 2017, dem giv am 15th Aare Ona kakanfo of Yorubaland by oba Adeyemi III, di Aaafjn of Oyo. Pesin wey get di title bifor am na Chief Moshood Abiola bifor e kpai in 1998.