Folashade Ogunsola

From Wikipedia

Folasade Tolulope Ogunsola (dem bon am for 1958) na Naija professor of medical microbiology, an na vice-Chancellor fo University of Lagos. Shi sabi hep pipul wey get HIV/AIDS. Ogusola na fest oga for College of Medicine wey bi woman. Na shi stil bi Deputy Vice Chancellor for di skul insaid 2017 an 2021. Wen wahala dey for di skul na Ogunsola dem tok say mek e dey as di Vice Chancellor for di skul.

How e stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for University of Ibadan shi sta fo smol wit im papa, Akin Mogbogunle wey bi lecturer. Na Queen's College, Legos skul shi go. Bitwin 1974 an 1982 shi go University of Ife fo Degree.