Festus Keyamo

From Wikipedia
Festus Keyamo
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemFestus Chenj-am
Famili nemKeyamo Chenj-am
Wen dem bon am21 January 1970 Chenj-am
Ples wey dem bon amDelta State Chenj-am
Wok wey e dey dulawyer, Senior Advocate of Nigeria, critic, columnist, human rights activist Chenj-am
Post wey e deyMinister of State for Niger Delta Affairs, Minister of State for Labour and Employment, Senior Advocate of Nigeria Chenj-am
Wie e go skulAmbrose Alli University Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Festus Egwarewa Keyamo SAN, FCIArb (dey bon am 21 January 1970) na Naija lorya, jornalist, an pesin wey dey fight for pipo wey dey do pashiha. Forma presidet Muhammadu Buhari chuz Keyamo as e daretor of Stratejik Komunikeshon wen e wan enta as presidet for sekod time.

How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 21 January 1970 dey bon Festus Egwarewa Keyamo in Ughelli wey de Delta Stet, Naija. Keyamo papa kom from Effurun, one siti in Delta Stet.

Keyamo go Model Pamri Skul an do e sekondiri skul for Govamet Kolej, Ughelli. E do e WASSCE for di skul in 1986. Keyamo leta enta Ambrose Alli Yunivasiti wey de Ekpoma in Edo Stet to rid Law . Na for 1992 e kolet e B.sc satifiket in Law an e kwulify to go kot for December 1993.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na onda Gani Fawehinmi law ofis e tek start to wok as lorya. E start di wok in 1993for Gani Fawehinmi ofis wey de Legos Stet. Afta Keyamo don wok for two years for di ofis, e komot go fom e own Festus Keyamo Chambers

Na Keyamo bi lorya of Mujahid Dokubo-Asari for di kess wey e get with Fediral Govamet. Asari Dokubo bi di lida of Niger-Delta Pipo Volontiha Forss. Na stil Keyamo bi di lorya wey difen Ralph Uwazuruike. Ralph Uwazuruike bi di lida of di grup wey dey fight for Biafra Riploblik MASSOB. Keyamo na one of di lorya wey chuk bodi for di kess of Bola Ige killin. Keyamo in 2008 kari Fediral Govamet go kot bikos of di magomago way dem tek dey pik sarvis shif. For 2017, na Keyamo Stephanie Otobo chuz to helep am kari pasto Johnson Suleiman go kot. Stephanie-Otobo wey bi singa tok sey di pasto slip with am finish no gree mari am again.

How e tek wok for politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 24 September 2019, Fediral Govamet chuz Keyamo as Minista of Stet, for Niger Delta. Froma Naija presidet, Muhammadu Buhari leta chenj e wok to Minista of Lebor an Emplomet.

Awod wey e don kolet[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • For July 2017, e risiv SAN rank.
  • Global Human Rights Award for September 2017 give am awod for e wok as e dey fight for human right for Naija.