Femi Fani-Kayode

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Femi Fani-Kayode
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am16 October 1960 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Pesin wey e mariSaratu Atta, Precious Chikwendu Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dulawyer, politician, essayist, poet Chenj-am
Post wey e deyMinister of Aviation of Nigeria, Minister of Culture and Tourism Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
Official websitehttp://www.femifanikayode.org/ Chenj-am

David Oluwafemi Adewunmi Abdullateef Fani-Kayode (dem bon am for 16 October 1960) na Naija Politishian, buk raita an Lorya.Im na bifor bifor Peoples Democratic Party (PDP) memba. E dey wit All Progressive Party (APC) now.Femi-Kayode famili-dem kom fom Osun Stet but na [Lagos|Legos]] dem bon am to shif Victor Babaremilekun Adetokunbo Fani-Kayode an shif (Mrs) Adia Adunni Fani-Kayode. Fani-Kayode na bifor bifor Spesphal Assistant (Public Affairs) to President Olusegun Obasanjo. Na bifor bifor Minista of Kolsho an Tourism of di Fediral Repoblik of Nigeria fom 22 June to 7 November 2006 an bifor bifor Minista of Aviation fom 7 November 2006 to 29 May 2007.

How e tek stat life an Skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fani Kayode papa na lorya wey plenti pipul sabi wel wel for Naija. Victor Babaremilekun Adetokunbo Fani-Kayode, wey bi Femi papa na lida for "National Council Of Nigeria and Cameroons,", Minista for lokal govment Cheiftaincy Affairs.

Femi Fani-Kayode stat skul wen e dey 8 years old. In 1980 e go University of London School. E kon leta go Cambridge University go rid law. Femi Fani-Kayode stil go Naija law skul. In 1993, Femi Fani-Kayode bi Pentacostal Christian for Ghana. E go skul bak go rid Theology and finish in di year 1995.

Politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Femi Fani-Kayode na memba for "Nigeria National Congress" (NNC) for 1989. Na im stil bi di youth lida for NNC in 1989. In 1990, Fani-Kayode bi di shif Press Sekretiri to shif Tom Ikimi.Fani-Kayode join "National Democratic Coalition" (NADECO).Fani-Kayode na bifor bifor Naija President Olusegun Obasanjo kampain tim. Afta Obasanjo win di eleshion, Fani-Kayode kom bi one of Obasanjo Spesphal Advaisa.In 2016, Fani-Kayode bi di Minista of Kolshor an Tourism an dey leta chenj am to Minista of Aviashion.

Smol wahala an smoke kase wey e get[chenj-am | chenj-am for orijin]

Economic and Financial Crime Commission (EFCC) arest am for July 2008, dem tok sey e no abaut di 19.5 billion naira Aviashion moni wey dem dey investiget. Pipul wey dey mek law for Senate kon tok sey mek dem no giv am post for 5 years but leta chenj dia mind abaut cat desision.

For December 2018, Economic and Financial Crime Commission (EFCC) arest Fani-Kayode sey e yuz Govament moni enihow. Fani Kayode tok sey na im biznes moni e dey yuz du tins no bi Govament moni.

Im pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Femi Fani-Kayode don mari four times. Im fest mari Saratu "Baby" Atta insaid 1987 but for insaid 1990 dem no kon dey togeda again. Dem bon one pikin wey im nem na Oluwafoluke. Di sekond pesin wey e mari na Yemisi Olasunbo Adeniji in 1991 but di marej skata in 1995.Yemisi Olasunb bon three pikin wey dia nem bi Oluwatemitope, Oluwatobiloba an Oluwatumininu. Di nomba three pesin wey e mari na Regina-Hanson Amonoo. Na 1997 dem mari an get one pikin, wey im nem bi Oluwaremilekun.In year 2014, Fani-Kayode an Precious Chikwendu, wey bi "Miss United Nations" (2014), mari diaself. Na dis one mek am di nomba four pesin wey e mari. Na February 1, 2016 Fani-Kayode an im wife bon dia fest pikin. Dem giv di pikin Kristen nem wey bi Joshua Oluwafemi Emmanuel Latanna Aragon Fani-Kayode. Na di pikin bi Fani-Kayode fest son. For 25 May 2018 Precious Chikwendu Fani-Kayode bon anoda three boys for Femi Fani-Kayode. Dia nem na:

1. Ranger, Alexander, Okunade, Olusegun, Ikenna Fani-Kayode

2. Adrien, Daniel, Olumide, Jidenna, Benaniah Fani-Kayode.

3. Liam, Micheal, Oluwanifemi, Tobenna, Jehu Fani-Kayode

Femi Fani-Kayode sinio broda Rotimi Fani-Kayode, raita wey pipul sabi wel wel. E kpai in 1989.