Fati Muhammad

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Fati Muhammad
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Famili nemMuhammad Chenj-am
Wen dem bon am15 June 1982 Chenj-am
Ples wey dem bon amKano state Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Hausa langwej Chenj-am
Wok wey e dey dufilm actor, actor Chenj-am

Fati Muhammad (Dem bon am June 15, 1982) na forma Naijá aktress wey dey akt for Hausa fim indostri kol Kannywood.Fati dey amog di aktress wey du wel wel for di year 2000.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na fom smol pikin Fati don wan bi aktress. Fati go mit di Hausa dareto Tahir Muhammad Fagge and Tahir go mit di Hausa produsa Ishaq Sidi.Ishaq kom let am akt for di fim Da Babu an na di fim mek Fati popula wel wel.Afta e akt for Da Babu, meni Hausa fim produsa stat to dey put am for dia fun tu.Fati don du meni fims.

Fim wey e don akt[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Sangaya
  • Zarge
  • Marainiya
  • Mujadala
  • Kudiri
  • Tutar So
  • Garwashi
  • Tawakkali
  • Gasa
  • Abadan Da'iman
  • Zo mu Zauna
  • Tangarda
  • Hujja
  • Al'ajabi
  • Halacci
  • Samodara
  • Zumunci
  • Murmushin Alkawari
  • Gimbiya
  • Bakandamiya
  • Taskan Rayuwa
  • Nagoma an
  • Babban Gari. Fati tok sey e no go dey akt fim again bot e stil dey produs fim.

Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta Fatima marri Sani Mai Iska wey bi aktor dey komot for Naijá go London.Wen di marej skata, Fati kom bak to Naijá an Kontiniu to dey akt. Wen Fati see sey tins ni dey go norma for di indostri, Fati no kom dey akt.Fati marri anoda man wey e nem na Umaru Kanu wey bi fim meka inside Kannywood industri an na broda to singa Ali Jita.Di marej stil skata afta smol taim. Fati no bon pikin and shi no marri enibodi again.Fati pik one boi an stat to dey train am. For 2019, Fati bi di MC for di Hope Party for dia Politikal.Fati don tok sey e wan dey du politiks now.