Eniola Ajao

From Wikipedia
Eniola_Badmus

Eniola Ajao na Naijá aktres wey kom fom Epe Lagos State. Eniola don akt insaid ova 75 fim. Pipul no am wel wel bikos e fit akt diffren diffren rol for fim.

How e tek stat life an skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Eniola na twins an im an e sista bi di last bon of di six pikin wey dia papa and mama bon.Eniola go Saint Michael’s Anglican Primary School an Army Secondary School for Epe.Eniola go Yaba College of Technology an den University of Lagos wia e rid Accounting.Eniola wan bi Aktres sins wen e bi smol pikin. .Meni pipul tok sey e dey folo Odunlade Adekola bot Eniola tok sey na lai pipul dey lai abaut im sey im dey folo Odunlade Adekola.

How e tek akt fim[chenj-am | chenj-am for orijin]

"Ìgbà Aìmọ̀" bi di fest fim wey Eniola akt inside an na 2004 dey produs am. . Oda fim wey shi akt na :

  • Eniola
  • Erin Orin
  • Daramola.

Eniola dey di December 2018 fim Vendor. Inside di fin, Eniola akt as Yele Ara.E dey for di aktress wey fit win for di Katigori Best Actress in a Supporting Role in a Yoruba- Language Film at di 2015 Best of Nollywood Awards, bot e no win di awod.