Enid Porter

From Wikipedia
Enid Porter
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromUnited Kingdom of Great Britain and Ireland, UK Chenj-am
Fest nemEnid, Mary Chenj-am
Famili nemPorter Chenj-am
Wen dem bon am8 October 1908 Chenj-am
Ples wey dem bon amWestcliff-on-Sea, Southend-on-Sea Chenj-am
Wen e kpai16 January 1984 Chenj-am
Place of deathRoyal Papworth Hospital Chenj-am
Pesin wey e marino value Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dufolklorist, historian, curator, teacher Chenj-am
Wie e go skulUniversity College London, Southend High School for Girls Chenj-am
Work locationMuseum of Cambridge Chenj-am

Enid Porter (dem bon am for October 8, 1908 an e kpai for January 16, 1984) na pesin wey dey stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way in Cambridgeshire. Enid Mary Porter na pesin wey don wok for long time as e dey kolet an kip old old tins for Museum of Cambridge as e wok from 1947 go rish 1976. E wok rili helep to rekod di kolsho an sosha life of Cambridgeshire pipul. Enid tink an yuz sens as e dey hep kolet soshal histri of pipul. E dey allow pipul to tok dia histri an mek suo pipul tok abaut aria wey oda pipul wey dey stodi an rekod how pipul dey du tins for old way no like to du. Enid buks wey dey Museum of Cambridge get beta beta informashon about kostom, tori an song of Cambridgeshire pipul.

How e ten stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Westcliff-on-Sea, Essex, dey bon Enid Mary Porter on October 8, 1908. E papa nem na Hugh Porter an e mama nem na Ethel Mary Porter. Enid papa Hugh, kom from Bedford an e du e tisha tranin at a hiya-grade skul for Cambridge. E papa dey tish bifor for "Southend High School". Enid mama Ether Mary ( bifor e mari e papa nem na Scott) kom from di famili wey don tey for Cambridge sins Seventeen senturi. Bikos of e mama famili histri, Enid dey go visit e mama famili memba for Cambridge an e sabi di aria wel wel. Enid dey always dey rekod tradishonal tori wey e mama famili memba dey tel am. Di Portel famili-dem rili go skul wel wel an get pipul wey dey wok for dem onti di fest wold war stat. Afta wey Enid go rid modern langwej at Yunivasiti Kolej London ( na inside di yunivasiti di Folklore Sosaheti Librari dey sins 1911). Enid folo e papa an kolet tranin at di Katolik Tranin Kolej, London an den stat to dey tish for difren difren skul onti di sekod wold war stat.