Ella Mary Leather

From Wikipedia
Ella Mary Leather
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromUK Chenj-am
Orijina nemElla Mary Smith Chenj-am
Fest nemElla Chenj-am
Wen dem bon am26 March 1874 Chenj-am
Ples wey dem bon amDilwyn Chenj-am
Wen e kpai7 June 1928 Chenj-am
Place of deathWeobley Chenj-am
Cause of deathheart disease Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dufolklorist Chenj-am

Ella Mary Leather (26 March 1874 – 7 June 1928) na one woman wey kom from Britain wey dey gada kolshor-dem and Herefordshire muzik-dem. Dem dey see her wok "Folklore of Herefordshire", wey she rait for 1912 as the "gud ezampu wey sayence go uze dey do gud gud tins for pipu for free". Som of di wok wey she do na Twelve Traditional Carols from Herefordshire,im rait am wit Ralph Vaughn and plenti small small buk for inside the kolsho-dem mata.

How im stat laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ella Mary Smith for 26 March 1874 for one smoll place for Bidney for Dilwyn parish, wey dey for Herefordshire for England. Na Mary Ann (née Griffiths) and James Smith, wey be farmer born am. Afta she finish Clyde Skool, she finish her school for Hereford High School for Girls. Im marry one man wey dey gada tins wey e name bi Francis Leather for 1893 and di two of dem move go one town wey be Woebley wia dey born dia three boy-pikin-dem wey bi John Francis, Geoffrey and Godfrey.

The kaind wok im do[chenj-am | chenj-am for orijin]

Nobodi know wen Leather fess stat to dey gada kolshor-dem but for 1904 som of her smol-smol buk sho sey she bin don alredi gada plenti pipu wey dey follow am gada kolshor-dem wey she dey folo wok dat taime to tek gada kolshor-muzik for dat plec. One man wey dey rair buk-dem wey im name na Reverend Compton Reade ask Mar sey mek im sef folo raite one chapta wey bi "The Folk-Lore of the Shire" to di buk-dem wey dem tek dey rememba pipu wey don live for Old Herefordshire wey dem bring kom awtside dat year. For 1905, she put dem di buk-dem Folk-Lore and the Folk-Song Societies. togeda. As e bi sey she no too sabi, muzik, e kom mek am hard for am to bring muzik raiting until 1906 wen dey put am to meet one man wey dey sing muzik wey dem dey kol Ralph Vaughan Williams. Williams hep am get one machine wey sabi do new muzik and stil do muzik wey dem don do befor. For 1907, her she kom get levul wel-wel for kolshor-dem kom strong wel-wel, wen im bring one buk about kolshor-dem wey be di fest Herefordshire buk.