Abdulrasheed Bawa

From Wikipedia

Abdulrasheed Bawa ( dey bon am 30 April 1980) na Naija pesin wey dey wok for di komitee wey dey kash pipo wey no folo law for Naija. Bawa na di oga patapata for EFCC Ekonomik an Finashal Krime Kommishon from 24 February 2021go rish 14 June 2023. Bawa tek ova di posishon of oga patapata of EFCC from Umar Mohammed Abba. Bifor Bawa get dis posishon, e na Deputi Daretor for di anti-graft agency.

Na on 16 February 2021 dey put Bawa nem for di pesin wey go tek ova di oga of EFCC, but di Nashonal Hasembili chuz am on 24 February 2021.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na 30 April 1980 dey bon Abdulrasheed Bawa. E kom from Jega, wey de Kebbi Stet.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na 30 April 1980 dey bon Abdulrasheed Bawa. E kom from Jega, wey de Kebbi Stet.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bawa go Model pamari skul Birnin-Kebbi an e finish di skul in 1991. Bawa kom finish Govamet Sekondiri Skul, Owerri in 1997. For 2001, Bawa finish from Usmanu Danfodio Yunivasiti, Sokoto wey e tek get e Bachelor of Ekonomik satifiket. E do e Masta digree from Usmanu Danfodio Yunivasiti wey e tek rid Intanashonal Affairs an Diplomesi in 2012. Bawa stil dey rid Laws for Yunivasiti of London. Bawa stil kolet trenin from United States Federal Bureau of Investigation (FBI), [Financial crimes Enforcement Network]] (FINCEN), an United Nations Office on Drugs and Crime (UNODC).

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • 2014

Na 2014 Bawa join EFCC as di Hasistans Detective Superintendent (ADS)

  • 2015

For October 2015, na Bawa chairman di investigashon kommitee wey handu Diezani Allson-Madueke. Diezani na di forma Minista of Petiroliom Risosis wey pipo hakus of magomago with govamet moni. Bawa bi di yongest oga patapata wey EFCC wan get.

  • 2023

For June 2023, Naija presidor Bola Tinubu sospen Bawa bikos e no yuz e posishon as EFCC do beta tins.