Ebira People

From Wikipedia

Ebira Pipo na one tribe in North-Senta in Naija wey get dia kolshora langwej wey dem dey spik by demsef. Pesin fit see Ebira pipo in Kogi Stet an NasarawaStet. Dia langwej bi like Nupoid one wey dem dey spik for Benue-Congo. Di langwej na part of Niger-Congo langwej famili.

Wen dem neva komot Kogi Stet from Kwara Stet, na from Okene Ebira pipo chuz as dia main sentra an na from Okene dem tek dey kontro di Ebira langwej an kolsho. Afta wey dem form Kogi Stet, Pesin go see di Ebira pipo in five difren lokal govament in Kogi stet: Adavi, Ajaokuta, Okehi, an Ogorimagongo. You fit still see plenti of Ebira pipo for Abuja ( Abuja na di fedira kampita of Naija), an Nasarawa Stet. For Nasarawa Stet, Ebira pipo plenti in Toto LGA. Di Eganyi pipo plenti in Ajaokuta LGA. Di Etuno pipo plenti in Igarra town of Agorimagongo, Okehi, an Okene. Each town get dia admin senta. You go see Ebira Koto in Kogi an Koton Karfe LGA, Bassa LGA, Lokoja. Ebira Koto pipo still dey FCT , Akoko Edo LGA in Edo Stet Pipo don kol dis Ebira pipo meni nem bifor. Some of di nem na: Igbira, Ebirra, Egbirra, Ibira, Ibirra, an Egbira.