DJ Kaywise

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

''Bold textAyomide Kehinde Okiki(bon 4 August 1992 ) dem no am as DJ Kaywise na naija disk jOker an rekod produsa Kaywise stat fom Alaba market for 2010. Pipul don sabi am insaid for naija wela. E don du meni naija mix tape for meni top stars for naija muzik.

How e tek stat life=[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Legos stet, Nigeria dem bon am for August 4, 1992. Im perent kom from Ile Ife for Osun stet. Na for Legos stet dem tren am an na thier e tek grow, na for their e do im primary an sekondri skul. E popular wen e rilis di mixtape Emergency wey get different naija songs wey dem sing dat time for Alaba market for Legos Stet.

Karier[chenj-am | chenj-am for orijin]

DJ Kaywise stat im karier as rekod produsa na for leta e kon stat to dey du Disk Jockey. E stat in DJ wok for 2010. Na wen im rilis di mixtape "Emergency" na dat time pipul kon no am well well. E don rilis more dan 10,000 CD mixtape, over 50 online rilis mixtape an rilis meni muzik an visuals wit Nigerian an Afrika artist.

Kaywise rilis im debut single for 2012, wey bi "hangover" wit Dammy Krane an Yung 6ix in 2013, e stil du song wit Iyanya wey bi "Loyalist". E Don rilis plenti single wit meni Naija musishan som of dem na Mayorkun, Naira Marley, Tiwa Savage, Olamide, Vector an Ice Prince. E stat im DJ akedemi for 2019 wet e lol do nem Kaywise Academi. Den rilis anoda mixtape wey bi "Revolution Mix Vol1" wey im du for EndSars Muvment wey hapun for Naija for 2020. For August 2020 E do anoda single "What Type of Dance" fishorin Mayorkun, Naira Marley, an Zlatan Ibile, di song dey for nomba 5 for Billboard Top Thriller Chat. Im letest song "high way" fishorin phyno komot for Desemba 2020. Do single dey for nomba 7 afta spendin two weeks for Billboard Top Thriller Global Chart.

Di Joor Konsat[chenj-am | chenj-am for orijin]

DJ Kaywise du di maiden edishon of im strit konsat wey im kol "The Joor Concert" for 2016. For one interview e tok sey di fes four of di konsat get plenti pipul wey kom wey rish like 50,000(unverifiable). DJ Kaywise du di fifth edishon for January 2020. For Di past years now dem don dey du di Joor konsat for different Sitis for outside di kontri an e Don du two edishon for London an Dubai.

Singles[chenj-am | chenj-am for orijin]

• "Hangover" (Fishorin Dammy Krane an Yung6ix)(2012)

• "Loyalist" (fishorin Iyanya)(2013)

• "Feel Alright" (fishorinIceprince, Patoranking, R2bees)(2014)

• "Warn dem" (fishorin Oritse Femi)(2015)

• "Ibeji" (fishorin Olamide n Vector)(2015)

• "Informate" (fishorin Tiwa Savage)(2017)

• "Caro" (2016)

• "JuJu" (fishorin B-Red)(2017)

• "Alert" (fishorin Mr Eazi an DJ Maphorisa)(2018)

• "See Mary see Jesus" (fishorin Olamide)(2018)

• "Normal level" (fishorin Ice Prince, Emmy Gee an KLY)

• "W.T.O.D" (fishorin Naira Marley, Mayorkun an Zlatan Ibile)(2020)

• "Highway" (fishorin Phyno)(2021)

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

Best Nigerian DJ (All Youth Tush Awards (AYCA)(2014)

• DJ of the year (City People Entertainment awards)(2015)

• Male DJ of the year (Nigeria Entertainment Awards)(2015)

Wia wi gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. https://www.billboard.com/charts/toP-triller-global/2020-08-22

2. https://thenet.ng/dj-kaywise-the-former-church-drummer-who-has-become-a-chart-topping-dj/

3. https://notjustok.com/tag/dj-kaywise/

4. https://thenet.ng/net-honours-2021-dj-kaywises-highway-named-most-played-street-hop-song/

5. https://web.archive.org/web/20220807190446/https://thepoise.ng/dj-kaywise-launches-disc-jockeying-academy/