DJ Cuppy

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Florence Ifeoluwa Otedola(Dem bon am for November 11, 1992) we pipul no as DJ Cuppy, Cuppy na Naijà fimale DJ and pesin wey dey mek muzik.Im bi di fimale pikin of Naijá bizness man Femi Otedola. Na Legos im ta grow up bifo im com go London wen im bi 13 yess old.

Hau im tek stat life an Skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Cuppy live for Ilupeju for six yess bifo Im kon move to Ikeja wey im kom go Grange Skol, Ikeja. Cuppy kom de stay for London an na for London i tek do GCSEs an anoda exam wey dem dey kal A-Level.Im pass out fom King's College London in July 2014 wit a degree satificate for pupi wey stodi bizness an ekonomi matta. For 2015, im get masta degree for pupi wey go stodi music bizness fom New York Univasiti.For October 2021, Cuppy enta Univasiti of Oxford and Im wan go get masta satificate for pupi wey stodi Afirica Stodi.

Hau Im tek Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Cuppy dem pick to bi di DJ we go bi wit Dem wen de do MTV Africa Music Awards for Durban in 2014. Cuppy do DJ for Taller and Christie's Art Ball for London, and she do DJ for Financial Times Luxury Summit wey happun for Mexico Citi. For July 2014, she do ha first CD we get plenti plenti different song and im name am House of Cuppy and di parti happun for New York on September 2, 2014. For di same year, Cuppy opun i podorshion group we bi Red Velvet Music Group and na London di group dé Na Cuppy foto dey di furont kova of Guardian Life Magazine. Di magazine de tak abaut young wimen fo Africa.Fo March 2015, na Cuppy Oil Barons Charity pick mak i do DJ for dem in Dubai. Dis chariti show we i go do DJ make am di nọba wan Afirica pesin we go do dat kind tin for Oil Barons Charity.Cuppy de di 2015 April/May magazine of Forbes Wuman Africa. Cuppy do House of Cuppy II in June 2015. Fo August 2015, Cuppy stat to go do DJ for 8 different different Africa kontries and dat traful bi di fest we Im wan go do DJ for different kontris.Di kontris Dem bi Naijá,Seniga, Gana, Kenya, Uganda, Riwanda, Saout Afirica, Tasania. Dat show go inklud mek oda muzishian join am.

Patan of im muzik[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wan intavihu we i do wit Trush , Cuppy tok se im muzik na "neo-Afrobeat" na cobinashion of Electro house an Afrobeats.

Parsona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

DJ Cuppy tok on April 14, 2020 fo Twitter se im no de chop meit, se na onli Vegitebu i de chop. Cuppy papa dash am eighty milion Ferari Kar duri Corona varus tame.Cuppy get hause for Unated Kingdom an i name am PinkPentHouse.Pipul see di hause fo MTV cribs on 8th of April, 2015.