Cyrus Chothia

From Wikipedia
Cyrus Chothia
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromUK Chenj-am
Nem for lokal langwejCyrus Chothia Chenj-am
Orijina nemCyrus Homi Chothia Chenj-am
Fest nemCyrus Chenj-am
Wen dem bon am19 February 1942 Chenj-am
Wen e kpai26 November 2019 Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dubioinformatician Chenj-am
Wu e dey wok forWolfson College, University College London, Laboratory of Molecular Biology, University of Cambridge Chenj-am
Wie e go skulUniversity College London, Birkbeck, University of London, Durham University, Alleyn's School Chenj-am
Doctoral advisorPeter Pauling Chenj-am
Memba ofRoyal Society Chenj-am
Awod wey e koletFellow of the Royal Society, ISCB Senior Scientist Award, ISCB Fellow, Dan David Prize Chenj-am

Cyrus Homi Chothia (19 February — 26 November 2019) na England sayentist wey don stodi how tins de happen inside livin tin (Biokemist). E don ritaya for Medical Research Council (MRC), Laboratory of Molecular Biology (LMB)for Yunifasiti of Cambridge an e bi fellow for Wolfson kolej.Chothia leta go Durham Yunifasiti kom get Bashelor for Seyens digri for 1965. Chothia kom konplit e Master of Sayens digri for Birkbeck Kolej for 1967 and PhD for Yunifasiti Kolej London.Na Linus Pauling son Peter Pauling bi e supafaisor.

E research an wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta Im PhD,Chothia work for Laboratory of Molecular Biology (LMB)for three yias. E kom wok wit Micheal Levitt for Weizman Institute of Science and e stil wok wit Joel Janin for Institute Pasteur for Paris. For 1976, Chothia kom go England bak go work for University College London and Im work for LMB.E join-bodi wit Arthur Lesk tek sho sey proteins dem dey folo join-bodi to chenj hai dem bi for inside bodi. For 1992,E tok sey plenti plenti Proteins dem dey wey get smol smol size. E stil join-bodi wit Alexey Murzin, Steven Brenner and Tim Hubbard tek do di Structural Classification of Proteins Database(SCOP),one kain Preodic Table wey dey for proteins dem. E stil wok Julian Gough tek do Superfamily Database wey dey yuz Hidden Horkov Model tek know difren difren stej dem wey bi like di one wey pipul don know bifor. As Im dey wok dey go,Chothia supafais 19 student dem wey do PhD,dia nem dem na Alex Bateman,Steven E.Brenner, Mark Bander Gerstein,Julian Gough,Sarah Teichmann,Bissau Al-Lazikani,Goga Apic Samantha Berre,Mathew Bashton,Dan Bolser,Micheal Bremang,Bernard do Bono, Emma Ganley(nee Hill), Martin Madera, Siarhei Maslau, Susan Miller, Jong Park (aka Jong Bhark),Rajkumar Sasidharan and Christine Vogel.

Im Awod and Honor Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem elekt Chothia as Fellow of do Royal Society (FRS) for Yia 2000.

For inside Im Satifiket, dem rait sey:

Dr. Chothia don sho as Amino sequence for Protein dem dey arenj dem sef, as dem dey wok and hau dem tek kom life.As Im tek tok di mata, e don sho us as dem tek dey for difren difren klas wey meni pipul don know.E don sho as Proteins dem dey chenj and as dem dey do oda tins dem.E don helep us know sey as Proteins dem dey difren-difren don mek dem fit alau Immunoglobin dem to fit know plenti-plenti difren Antigens.For 2015, dem elekt Chothia as Fellow of International Society for Computational Biology ((ISCB)and dem gif am di ISCB Accomplishment by a Senior Scientist Awod bikos of hau e tek yuz Computation tek know as Proteins dem tek dey.David Haussler and Micheal Waterman dem sef kolet Awod di sembtime wey Chothia kolet Dan David Prize Awod for Yia 2015 bikos of efri tin dem wey e do do for Bioinformatics wok dem.