Chike

From Wikipedia
Chike
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejChike Ezekpeazu Osebuka Chenj-am
Fest nemChike Chenj-am
Wen dem bon am28 January 1993 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Fest langwejIgbo langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej, Igbo langwej Chenj-am
Wok wey e dey dusinga, pesin wey dey rait song, entertainer, entrepreneur, actor Chenj-am
Wie e go skulCovenant University Chenj-am
Wen e stat wok2009 Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
Indigenous toAnambra State Chenj-am
Stai of song abi fimhighlife, rhythm and blues Chenj-am
Record labelUniversal Republic Records Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Chike Ezkpeazu Osebuka (dem bon am for January 28, 1993), dem sabi am for im wok as Chike, na Naijà singa, song raita an fim aktor. E dey insaid Naija competishion Project Fame Afrika an e kari sekond on season 1 of di voice Nigeria. Fest fim wey Chike go dey insaid na Battleground wey dem dey holways sho for Africa Magic showcase, na im bi Mayowa Badmus insaid di fim.

Hau e tek stat life an skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Chike kom fom Onitsha, Anambra stet in Nigeria. Na four pikin im papa an mama bon e dey insaid di four pikin. Chike famili na dem hep am dey sing. E go Covenant University an get digre in Computer Engineering.[1]

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Project Fame

Chike dey insaid project fame West Africa, but e leta komot wen e rish top 10.

The Voice Nigeria

Chike dey insaid The Voice Nigeria afta e sing James Arthur "Roses", e dey for team Patoranking syd.

Insaid di sho e sing Mario's Let me love you song wit anoda memba for team Patoranking, wey mek am enta nex stage. For di sho e du Dare Art Alade "Not the girl" song. For di sekond stage for di sho e du The Weekend's "Earned it" an na pipu wey dey luk di sho hep am pas di round.

Afta di Voice of Africa

2016

Afta di voice Nigeria, E sign for Universal Republic rekod wit som oda pipu wey du di sho. E rilis im fest single Fancy U in December 2016 onda Universal Republic, wit di musik video wey kom out for 2017. Chike na ambassador for Airtel Nigeria.

2017-2019

In April 2017, Chike nem dey insaid africa magic na im bi Mayowa Badmus in television nem Battleground. Chike kon komot for Universal Republic in November 2017. E rilis im nex single, wey bi "Beautiful people", in February 2018.

2020

Chike rilis im 14 track album wey bi 'Boo of the Booless.' wen e pafom on di 2020 Big Brother Lockdown TV sho.

2022

In August Chike sel im car for am to rilis album, e kon tel pipu wey lik am sey mek dem no wori wen dey ci am dey uze leg waka.

Som of im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Albums

Boo of di Booless

The Brother's Keeper

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Covenant University Artistes/The Cable Retrived 15 January 2023