Chika Anadu

From Wikipedia
Chika Anadu
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejChika Anadu Chenj-am
Orijina nemChika Anadu Chenj-am
Fest nemChika Chenj-am
Wen dem bon amNovember 1980 Chenj-am
Fest langwejIgbo langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Igbo langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dufilm director, screenwriter, film producer, actor, filmmaker Chenj-am
Wie e go skulNew York Film Academy Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Chika Anadu na Naija fimmeka wey pipu no for di fim wey i nem bi B for Boy (2013).Shi don writ and produce meni short fims.Pipu no Anadu fim for tackling issues of gender discrimination and culture pressure wey surround tradition for Naija.

How i stat life and edukashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Chika Anadu wey dem bon November 1980 for Lagos, Naija. Shi komot for Naija go du ha 'A' Levels, complete ha digree in law and criminology and shi kolet MA in African stodi;Human and sustainable Development. For one interview with New York fim Academy,Anadu tok sey shi like fim from smol but na 2016 shi reason to bikom fim direktor. Anadu kom Naija kom du ha youth service wey bi compulsory government work program for Naija Citizens with university digree. Shi watch one Italian fim Cinema Paradiso (1988) na dis fim ginger ha to bikom fim direktor.

Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Anadu kom bak Naija in 2008 con work for TV and Fim produkshon, shi no tu like am so shi stat to dey writ and shoot ha own short fim in October and November 2009.Ha fest short fim "Epilogue (2009) wey dem sho for 2010 San Diego Black fim festival for united state of America Ava (2010) wey dem sho for Cannes Fim Festival's Short Fim Corner in 2010.For 2010, di New York Fim Academy kom Naija for di fest time, to train pipu for 1 month in direkting, akting, screenwriting and camera work.Anadu choose scriptwriting instead of direkting even as shi no sey na direktor shi won bi.During dis time, Anadu apply to di Cannes Cinéfondation Residence Program in Paris. Di 14-page screenplay treatment dat was part of her submission was di basis for watin fit bikom ha fest feature-length film, B for Boy (2013).Anadu secure one of di six spots and moved to Paris to take part. She writ di screenplay for B for Boy (2013) during ha two-and-a-half-week stay.Anadu produce di fim with ha independent kompany No Blondes produkshon. Dey shot di fim for 17days, with Anadu working as direktor, writa, produsa, casting direktor, location scout, accountant, and lawyer. Na family money dem use du di fim.Anadu family contribute 70% of di cost, and ha producing partner Arie Esiri family contribute di remaining 30%. Dey sho B for Boy (2013) at di BFI London fim festival in 2013.Dem sho am for AFI where i win AFI fest 2013 Breakthrough Aword with $5,000 cash prize. Di fim premiere for Durban South Africa on July 19, 2014.