Brymo

From Wikipedia

Brymo (dey bon 9 May 1986) Ọlawale Ọlọfọrọ wey im ril nem na Olawale Ibrahim Ashimi for 9 May 1986. Meni pipul sabi am as Brymo an na song raita, na singa for Naija, an na musik pafoma, na aktor, an e stil dey rait buk. Dem bon am for Okokomaiko an na die e grow up, na sins wen e don dey for sekondri skul for 1999 e don dey rekod e musik dem. E sign Im rekod deal wit Chocolate City for 2010 bifor dem akius am for 2013 sey e fail tu pafom wetin e promise di rekod lebel. Brymo rilis his fest rekod albom wey e kol e nem Brymstone for 2007. E rilis his sekond albom for 2012 wey e koll dat one The Son of a Kapenta. E kom leta sing e singu musik dem laik Ara, Good Morning an Go Hard. For 20, October 2013, E rilis his third albom wey bi Merchants, Dealers & Slaves, an na dis two singu song e sing bifor dat taim som pipul wey dey kritisais musik dem giv beta koment for him musik.

For October 2014, Brymo rilis his nomba four studio albom wey bi Tabula Rasa an im musik wey bi Fe Mi na soft tradishonal musik. E rilis his nomba eight musik wey e pick from e oda song dem, e kom do dem togeda for e albom wey e kol Trance, for 8 December 2015. E do di song bikos of meni pipul wey dey for U.S an e konten som of e song wey dey e albom laik Merchants, Dealers & Slaves and Tabula Rasa. Brymo rilis his nomba five studio albom wey e kol Klĭtôrĭs for 9 May 2016; dey nominet am as di best: R&B/Pop Albom for di Headies 2016 an di albom as di albom of di year for di Headies 2018. For march 2018, Brymo rilis his nomba six albom wey pipul tok gud tin about wey bi Oṣó, wey e mix wit Yoruba song, e sopot di albom wit song laik Heya! an Bá’núsọ. Brymo join bodi wit three memba of Skata Vibration tu fom A.A.A, wey bi band wey bi alternative rock eponymous debut EP wey dem rilis for August 2019.

E rilis his nomba seven albom for studio wey e koll Yellow for 1 April 2020; dem nominet am for di best alternative albom and albom of di year for di Headies 2020. Brymo rilis him song wey no long rish albom but wey e nem am Libel for 5 November 2020. E get faiv track dem, Na Bigfoot prodiuz all di EP wit 'Deborah Prest wey bi guest singa. For September 2021, Brymo rilis back to back: Èsan and 9, Harmattan & Winter, as him nomba eight an nine albom dem for studio. E rilis his nomba ten albom for studio wey bi Theta for 27 May 2022 wey di albom konten 10 track dem an na for Naija pidgin e rekod all di song dem. Brymo kom show Mansa for poblik an him nomba elevun studio albom as e fest poblik sound pafomans for KAP Hub for March 2023. Im don rilis three buk dem wey bi; Oriri's Plight for (2018), Verses for (2020) an The Bad Tooth for (2022). an e show for di fim dem like Price of Admission for (2021) an Elesin Oba, The King's Horseman for (2022).

Im Studio Albom an Song Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Brymstone (2007)

The Son of a Kapenta (2012)

Merchants, Dealers & Slaves (2013)

Tabula Rasa (2014)

Klĭtôrĭs (2016) Oṣó (2018)

Yellow (2020)

9: Èsan (2021)

9: Harmattan & Winter (2021)

Theta (2022)

Mansa (2023)

Macabre (2023).

E Fim Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Price of Admission (2021)

Elesin Oba, The King's Horseman (2022).

Buk Dem Wey Im don Rait[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oriri's Plight (2018)

Verses (2020)

The Bad Tooth (2022).

Wie Dem Gada di Tori[chenj-am | chenj-am for orijin]