Bovi

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Bovi
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Industryfilm industry Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemBovi Chenj-am
Wen dem bon am25 September 1979 Chenj-am
Ples wey dem bon amBenin City Chenj-am
Fest langwejIgbo langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Igbo langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor, raita, screenwriter Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtheater arts, comedy Chenj-am
Wie e go skulDelta State University, Abraka Chenj-am
Academic degreebachelor's degree Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
FilmographyNneka the Pretty Serpent, My Village People Chenj-am
Nominated forAfrica Magic Viewers' Choice Awards Chenj-am
Official websitehttps://bovitv.com Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Bovi Ugboma na Naija stand-up comedian, aktor and writer. E don organize popula stand-up comedy concerts like Bovi: Man on Fire across di globe.

Im early life and school them wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Benin City, the capital of Edo State dem born Bovi. E attend UNIBEN staff school for primary education. For 1991, e start to go Government College, Ughelli for Delta State. For the sake of discipline and fear sey e no go get better character as youth, im parent remove am from boarding school to Edokpolor grammar school for Benin city wey them live. That move no work because them still move Bovi to anoda secondary school, Boys model secondary school, Onicha Olona, wey be boarding school. After e finish secondary education, e gain admission for 1998 to Delta State University where e study Theatre Arts.

Im work as comedian[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bovi start e career for April 2007, E appear for drama series wey be Extended Family. Na Bovi write and produce the drama. The show dey very popular, and by 2008 Bovi don de gain ground for comedy show and event throughout Nigeria. Na wen im appear for "Nite of a thousand Laughs" wey Opa Williams organize im blow. For 2013, e organize e first stand-up special for Eko convention center. He still do another one for 2014. Bovi- Man on Fire 2014 bring international superstar Ja Rule and Ashanti come perform. Bovi take the one-man special to several cities for United States, London, Melbourne, and Toronto. For 2017, the Man on Fire franchise return to Lagos and na im be the most successful. The fourth edition happen for Lagos for April 2019 and Bovi insists say na the last of the man on Fire franchise. E say im next special go get another title. Bovi start series wey the title na "BACK TO SCHOOL" for 2018 wey e dey upload for im YouTube channel. Bovi don work with other Nigerian comedian like I Go Dye, I Go Save, Basketmouth, Buchi, Odogwu, Okey Bakassi Julius Agwu and many others.