Bola Are

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Bola Are
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejBola Are Chenj-am
Orijina nemBola Are Chenj-am
Fest nemBola Chenj-am
Wen dem bon am1 October 1954 Chenj-am
Ples wey dem bon amEkiti West Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey dusinga Chenj-am
Wie e go skulThe Polytechnic, Ibadan, St. John's University Chenj-am
Academic degreedoctorate, diploma Chenj-am
Wen e stat wok1977 Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
Stai of song abi fimgospel music Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Bola Are (dem bon am for October 1, 1954) na Naijá gospel singa an bifor bifor Presido of di Gospel Musizishians Association of Nigeria.

How shi take stat[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem born Bola Are for Erio a town insaid Ekiti-West lokal govanment, of Ekiti Stet, southwesta Naijá on October 19, 1954 for di famili of Elda Babayomi an Mrs T. A. Babayomi of Erio, Ekiti Stet, Naijá

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bola Are go Christ Apostolic Church (CAC) Pamari skul wey dey im home town an afta fat e go Christ Apostolic Church Grammar School for Efon Alaye in Ekiti Stet bifor e kom go to The Polytechnic, Ibadan wey e diploma Satifiket in Accounting in 1973. For July 1985, dem awod Bola Are honorari doktorate digri in Music for St. John's University insaid United States of America

Im pasonal laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1977, Bola Are mari lait Pastor J.O Are an God bless dem wit meni pikin-dem. Som of di pikin wey dey bon bikom singa and muzishian.Na Bola Are fọm an stat The Bola Are School of Gospel Music International for July 2007 to gif gospel muzishian chans wey go lid dem to di way of di lord. For October 5, 2013, Bola Are du e 40 years on stage.

How tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bola Are stat to dey sing fom di taim wey e dey two years old.Bola don ditamine sey na God e wan folo fọm smol an e folo dat ditaminashion.Bola paret advais am mek e dey sing bigor e rish One year old an sins den, Bola don see imsef as bon singa.Afta Bola Are don du smol ministry finish, e form di Muzik band Bola and Her Spiritual Singers on June 26, 1973. In August 1977, Bola rilis fest muzikal albom Baba Ku Ise. As of 2014, Evangelist Bola Are don rilis ova 70 alboms

Albom wey e don rilis (1965 - 2000)[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Divine Praise of the King Of Kings – 1965
  • Ajaga Babiloni Wooo – 1967
  • Anointed Praise 2 – 1970
  • Bola Are Live – 1971
  • Agbara Esu Ko Da Nibiti Jesu Gbe Njoba – 1971
  • Homage 1 – 1974
  • Halleluyah Jesus Lives – 1974
  • Adura Owuro – 1977
  • Baba Kuse – 1977
  • Anointed Praise 1 – 1979
  • Jesus Is Coming Back, Be Ready! – 1981
  • Bibo Jesu Leekeji – 1988
  • Gbongbo Idile Jesse – 1991
  • Homage 2 (Tribute To Apostle T.O Obadare) – 1995
  • Lion Of Judah – 1995
  • Oore Ofe – 1998
  • Power In Praise – 2000
  • Apostle Joseph Ayodele Babalola – 2000