Bode George

From Wikipedia

Olabode Ibiyinka George ( dey bon am 21 November 1945) wey pipo no wel wel as Bode George na Naija politishan, wey bi forma militiri govno of Ondo Stet.Bode George leta bikom di oga patapata of NPA ( Nigeria Pot Hotoriti). Na Bode George stil bi di Vais-Chairman for di Sout-West Zone of PDP ( People's Democratic Party|Pipo Demokratik Parti]].

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 21 November 1945 dem bon Bode George. E get B.Sc an MBA satifiket. Bode kon bikom a kommanda for Nigeria Navy. Leta, from 1988 go rush 1990, na Bode George dey kontro Ondo Stet as dia militiri govno.

One Niuz-Pepa wey bi The African Corcorde tok sey Bode George no handu di bojet of Ondo Stet wel wel. Di pepa tok sey e jos dey give pipo bizness kontrat enihow an e go wan mek dem see-am for back. Bola Tinubu tok for one intaviu in July 2002 sey Bode George sopos go prisin for how e tek handu Ondo Stet. Wen Halaji Muhammed Muritala Ashorobi wan ansa Tinubu, e tok sey Bode George rili do e best for Ondo Stet. Di Halaji stil tok sey di buidin wey Bode George do for Ondo Stet na