Bet9ja

From Wikipedia
Bet9ja
website, business
Industrygambling Chenj-am
Inception2013 Chenj-am
Official nameBet9ja Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Located in the administrative territorial entityAbuja, Lagos Chenj-am
Parent organizationBet9ja Chenj-am
Has subsidiaryBet9ja Chenj-am
Language of work or nameEnglish langwej Chenj-am
Official websitehttp://mybet9ja.com Chenj-am

Bet9ja na one online bettin kompini wey pesin fit bet wen sport dey go on. Bet9ja get dia headkwuta for Naija. Dis kompini de onda KC Gaming Network Limited an na meni pipo from difren kontri dey kontro di kompini. Legos Stet give am pamishon to dey do di gamblin bizines an di kompini fit stil opun shop for oda part of di kontri. Out of all di websait wey pipo dey go pass for Naija, Bet9ja bi di nomba three. Na onli Google.com an Youtube.com pass am.

Alexa, wey bi pesin wey dey tok abaut how pipo dey chek wetin dey hapun for intanet wan tok, e sey na Bet9ja bi di fest loka websait wey Naija pipo dey chek pass. Alexa tok dis one in April 2020. Na onli Bet9ja out of all di websait wey de Naija mek di list of di most 500 websait wey pipo dey go pass in April 2020. Ayo Ojuroye an Kunle Soname bi di fonda of Bet9ja. Ayo Ojuroye bi di CEO an Kunle Soname bi di shiyaman. For 2022, Bet9ja bikom di sponso of Nigeria Professional Football League . Na Bet9ja sponso di 2019 edishon of Big Broda Naija.