Babatunde Raji Fashola

From Wikipedia
Babatunde Raji Fashola
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemBabatunde Chenj-am
Famili nemFashola Chenj-am
Wen dem bon am28 June 1963 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Pesin wey e mariAbimbola Fashola Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, lawyer Chenj-am
Post wey e deyLagos State Governor, Minister of Works and Housing, Minister of Power Chenj-am
Wie e go skulIgbobi College, University of Benin Chenj-am
Party wey e dey for politisAction Congress of Nigeria Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Babatunde Raji fashola (dem bon am on 28 June 1963) CON SAN, na Naija lorya an politishan wey sarf as Fediral Minista of Works an Housing of Nigeria fom 2019 rish 2023. Na im bi di bifor bifor Minista of power, works an Housing fom 2015 rish 2019. E don sarf as govnor of Lagos State fom 29 May 2007 rish 29 May 2015.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Fashola on 28 June 1963, insaid Lagos for Island Maternity Hospital, na Ademola Fashola famili dem tek bon am put, wey bi journalist wit di Daily Times of Nigeria, an Olufunke Agunbiade, wey bi nors.

Im kort wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem kol am for Nigerian Bar, Afta e finish profeshonal training programme at di Nigerian law School, Lagos wey e du in 1987 an 1988.

Honors[chenj-am | chenj-am for orijin]

E get Alumnus Awod fom di Universiti of Benin. E stil get Lagos state Poblik Serfis Awod bikos of di beta wok wey e dey du. E get Alliance for Democracy "Igbogbo Bayeku Lokal Govmet Awod" bikos hau e tek wok for di parti. Babatunde Fashola na patron for Law Students Association of di Universiti of Benin an na im bi di sekond lor pesin wey graduate from di Universiti of Benin an fest memba of di Nigeria Law School wey bi klas of 1988 wey go bi Senior Advocate of Nigeria. Na Fashola bi di fest Chief of Staff wey go get dat kain awod. Babatunde Fashola na memba of di Nigerian Bar Association, Di Internashonal Bar Association an e folo join bodi for Chartered Institute of Taxation of Nigeria.

In October 2022, Naija president Muhammadu Buhari giv am Commander of di Order of Niger (CON) , wey bi nashonal honor.

Politis wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fashola na Chief of Staff to forma Lagos state govnor,Asiwaju Bola Ahmed Tinubu. Fashola bi Chief of Staff, an honourabu Commissiona to Di Govnor's ofis dem time onda Asiwaju Bola Ahmed Tinubu. Babatunde Fashola sarf wel wel for Lagos State for difren department, lik:

Transitional Wok Grups- 1999.

Member of di panel of Enquiry into allocation of houses on di Mobolaji Johnson Housing Scheme at Lekki.- 2000.

Memba of di State Tenders Board- 2002– 2006.

Memba of di Lagos State Executive Council-2002-2006.

Memba of di State Security Council-2002-2006

Memba of the State Treasury Board-2002-2006

Chairman Ad-Hoc Committee wey dey Review of Asset distribution among Local Government.

Minista of Power, Works and Housing 2015-2019

Minister of Works and Housing 2019.

Govnor of Lagos State[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Action progress party wey kon leta bi All Progressive Party memba e bi enta as govnor of Lagos State afta Tinubu on 14 April 2017. Fashola enta sekond time on 26 April 2011.

Im Pasonal Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fashola Mari Abimbola Fashola. Dem bon two pikin.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]