Asisat Oshoala

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Asisat Oshoala
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Country for sportNaija Chenj-am
Ancestral homeNaija Chenj-am
Wen dem bon am9 October 1994 Chenj-am
Ples wey dem bon amIkorodu Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialityforward Chenj-am
Wie e dey livBarcelona Province Chenj-am
Wen e stat wok2009 Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
LeagueWomen's Super League Chenj-am
Awod wey e koletOkayAfrica 100 Women, African Women Footballer of the Year, Order of the Niger Chenj-am
Official website Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Asisat Lamina Oshoala MON (dem bon am for 9 October 1994) na Naija fimeli futbola wey play as strika for Primera Division klob FC Barcelona Fimeli an kaptain fo Naija wumen's nashonal tim. Meni pipul agre say shi dey fo Afrika bes wuman futbola an one of di bes fo di wod, na shi get awod pas fo Afrika futbola, shi don get four Afrikan women's futbola of di year awod.

Oshoala don play fo klobs in England lik Arsenal an Liverpool, Chinese klob Dalian, an Naijà Rivers Angels an FC Robo. Na shi win 2015 FA Women's kop wit Arsenal; two leaque championship an a kup wit Dalian; an di 2019-20 Copa de la Reina an 2019-20 supercopa de Espańa Femenina wit Barcelona. Na shi bi di first Afrikan(an Naijà) playa wey go skore goal fo UEFA Women's Champions League final, an wey hep Barcelona reech final 3 times, an one final. On 16 May 2021, Na shi bi di first Afrika woman wey go win Uefa Champions League, Afta Barcelona win Chelsea 4-0 fo finals.

Na shi skore goal pas fo di 2014 FIFA U -20 Women's world cup an na shi bi di bes playa fo di tonament. Na shi bi di bes playa fo an sekond persin wey skore pas fo Supa Falcon teem who win di 2014 FiFA women's Afrika Championship.

Fo September 2014, dem mek Oshaola nem dey fo Member of the Order of —the Niger .Na foma president of Naijà, wey bi Godluck Jonathan put Oshoala nem. Fo 2021 her nem dey insaid Forbes 30 onda 30.

Im Klob Karier[chenj-am | chenj-am for orijin]

LIVERPOOL 2015 - 2016

Na 23 January 2015, Oshoala join Liverpool fo England's women's supa Leaque. Di klob manaja, Matt Beard, tok say shi bi one of di bes playa fo di wod. Na shi bi di fes playa wey go play fo England women's Leaque.

Oshoala get wund fo leg an shi no play fo two month, Shi stil skore three goals fo Liverpool fo 2015. Di fes goal wey shi skore na di match dey play wit Brimigham City fo April 1. Wen Liverpool play wit Manchester City shi skore anoda goal. Shi kon skore di third goal fo Liverpool, wen dey play wit Arsenal fo 12 July.

Fo insaid January 2014, Liverpool tok say Oshoala don dey tok wit Arsenal fo niu kontract.

Arsenal:: 2016-2017 Fo March 2016 Oshaola du kontract wit Arsenal. Arsenal manaja tok say Oshoala sabi skore gooal wel an shi bi beta playa for di teem.

Oshoala hep Arsenal win di 2016 FIFA women's kop final fo May 14. wey bi di 14 kop wey di klob don win. Oshoala play 13 times fo di klop fo 2016 an na two goals shi skore.

Dalian Quanjuian Na 10 February shi du kontrat wit Chinese klob wey bi Dalian. Na fo 2017 season, shi skore 12 goals wey shi tek hep Dalian Quanjuain win kop. Na Shi kolet awod fo persin wey skore goal pass. Na dat year shi stil skore four goals, wey shi tek hep im klop win Shanghai 5-3 mek dem fo tek kari kop wey bi Women's Supa kop. For October 2018 shi hep im klob win di Championship League fo di sekond time.


FC BARCELONA: 2019- Present Fo 31 January 2019, Fc Barcelona sign Oshoala fo loan til di season go end. Fo May 31, 2019, Barcelona kon tok say dey don du anoda kontrat wit am til di end of di 2022. Shi skore seven goals fo seven match wey shi play fo di 2018-19 season. Barcelona finish sekond fo di season wit 25-2-3 rekod. Na Oshoala skore di onli goal wen Lyon win dem 4-1 fo 2019 UEFA Women's Champions League Final. Na shi bi di fes Naijà an Afrika wey go skore fo Champions League Final. Fo di 2019-20 season, Oshaola paly 19 times fo Barcelona. Shi skore two goals fo im klob wen dey play Atletico Madrid fo 19 September 2019. Fo October, shi skore two goals wey im teem win Real Madrid. Fo January 11, 2020, Oshoala skore four goals fo insaid di 6-0 wey im teem win CD Tacon. Na Barcelona dey fo nomba 1 fo di table dat year. Na Oshoala bi di sekond person wey skore pas, shi skore 20 goals.

Oshoala Kain Gam[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oshaola dey play fo Naijà team as Atakin Midfielder. Pipul dey kol am Seedorf. Na Superzee som of im frend dey kol am.

Kontri Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na September 2013 Oshoala fest play fo im kontri sinior teem.

Na Oshaola bi di bes playa fo di 2014 FIFA Onda 20 women wod kop, na shi kolet awod pas fo di 2014 women wod kop, shi skore seven goals. Na shi bi di bes playa fan sekond persin wey skore pas fo di Super Falcon teem wey win di 2014 Africa Women Championship. Na shi win di BBC awod fo women footballer of the year 2015. Fo September 2014, dem mek am Memba of di Order of Niger, na bifor Naijà president Ebele Godluck Jonathan give am.

Fo June 8 2015, Oshoala skore im fes 2015 FIFA Wumen's Wod kop goal, wen shi skore di sekond teem goal fo 3-3 draw wit Sweden insaid winnipeg. Oshaola dey amog di Supa Falcon teem wey win Afrika wumen championship fo 2016 an 2018. Shi skore three gaols fo di 2018 kup,wey dem play fo Ghana. Na Oshaola bi di sekond captain fo Supa falcon teem, fo di 2019 FIFA wumen's wod kop fo France. Na Oshaola skore fo di sekond match wey dey tek win South Korea 2-0. Na shi dem giv bes playa of di match. FIFA kol Oshaola nem fo insaid playa wey skore bes goal fo di Competition. Wit Oshaola di teem finish fo third fo grup A. Germany an Naijà play fo d nex stag,dem win Nigeria 3-0 fo di match.

Kontri Goals
Kompetition Goals Year
FIFA U-20 Wumen's wod kop 7 2014
FIFA Wumen's Wod kop 2 (1 fo 2015),(1 fo 2019)
Afrika Wumen's kop of Nation 13 (4 fo 2014),(6 fo 2016),(3fo2018)
Afrika Wumen's Kop of Nation's kolifikation 6 (4 fo 2014),(2 fo 2018)
CAF Wumen's Olympic kolification 2 (2 fo 2020)
Cyprus Wumen's kop 2 2 fo 2019
Turkish Wumen's kop 4 (4 fo 2021)

Honors[chenj-am | chenj-am for orijin]

Rivers Angels

.Nigerian Wumen's Championship : (2014)

.Nigerian Wumen's Kop: 2013, 2014

ARSENAL

.FA Wumen's Kop: 2015-16

Dalian Quanjian FC

.Chinese Wumen's Leaque : 2017, 2018

FC Barcelona

.Primera División: 2019-20,2020-21,2021-22

.UEFA Wumen's Champions Leaque: 2020-21,

.Supacopa dé Espańa Femenina: 2019-20,2021-22

.Copa de la Reina: 2019-20,2020-21

Nigeria .Afrika Wumen Championship: 2014,2016,2018

.FIFA U-20 Wumen's wod kop sekond position 2014

Individual

.BBC Wumen's futbola fo di year: 2015

.Queen fo di field awod 2014

.Afrika Wumen's futbola fo di year: 2014,2016,2017,2019,2022

.Afrika Wumen's Youth futbola fo di year: 2014

.Afrika Wumen's Championship Golden Ball: 2014

.Afrika Wumen's Championship Golden Booth: 2016

.FIFA U-20 Wumen's Championship Golden Booth : 2014

.FIFA U-20 Wumen's Wod kop Golden Ball: 2014

.Primera Division Top scorer: 2021-22

.Chinese Wumen's Supa Leaque Top Scorer: 2017

.IFFHS CAF Bes Wuman playa fo 10 years 2011- 2020

.IFFHS CAF Wumen team fo 10 years 2011 - 2020

.Eagles Naijà Wumen's most Valuable playa fo di season 2020-2021

Oda Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oshoala stat Oshaola Foundation to hep girls fo Afrika wey sabi play ball fo year 2019 .Na evri year shi dey arenj ball fo dem to dey play, wey dem dey kol futbol4girls fo Legos. Shi dey unda kontrat wit NIKE. Fo 2021, Asisat nem dey fo Forbes 30 unda 30. Fo October 2021, shi dey fo amog FIFA adviser grup, wet dey giv tel dem how to gro Wumen's futbol.

Pasonal Lif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oshaola tok sey Wen shi komot fo Skol go play ball im papa an Mama no sopot am. Na Moslem shi bi.