Ashleigh Plumptre

From Wikipedia
Ashleigh Plumptre
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromUK, Naija Chenj-am
Country for sportEngland, Naija Chenj-am
Fest nemAshleigh, Megan Chenj-am
Famili nemPlumptre Chenj-am
Wen dem bon am8 May 1998 Chenj-am
Ples wey dem bon amLeicester Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialitydefender Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Southern California Chenj-am
Member of sports teamUSC Trojans women's soccer, Notts County Women F.C., Leicester City W.F.C., Nigeria women's national football team Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am

Ashleigh Megan Plumptre (wey dem bon on 8 May 1998) na ogbonge futbola wey dey pley centra bak for Naija nashonal team. Na bifor bifor England youth Intanashonal playa, Shi fest pley for Nigeria in February 2022.

Klub wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Youth wok

Dem bon am for Leicester, Plumptre gro up an skul for Melton Mowbray. Shi stat to dey pley bol wen shi dey 4 years old. Na smol pikin of 4 years e bi wen e join Asfordby Amateurs. Web shi dey 8 years old, shi join Leicester City, shi uze seven years wit di klub an shi pley fom onda -10 to onda -15 levu for di klub. Shi komot for Leicester go join Birmingham City's onda -17 team in 2013. In 2014, Plumptre join third side FA Women's Premier League syd Derby county's.

Notts County[chenj-am | chenj-am for orijin]

Plumptre join WSL 1 team Notts County in 2014. Shi fes pley for dia sinior on 24 August 2014, wen e enta in 57th minutes for Caitlin Friend for match wey Liverpool win dem 1-0. Na shi bi di playa wey smol Pas wey go pley for Notts County at 16 years 108 days. Shi fest stat match for insaid 1 - 1 WSL 1 draw wit Manchester City on 3 September. Afta four days shi enta for pesin insaid League Cup Semi Final lus to Arsenal.

USC Trojans


In 2016, Plumptre muv go United States to pley college soccer for di University of Southern California. Shi enta for pesin seventeen times as midfielder for USC Trojans. Shi pley 27 minutes game insaid di College kup final. In 2019, Plumptre stat to dey pley as centra bak an shi pley hol 23 of USC's matches. Na human Biology shi go reed for skul an dat wan mek dem sabi am as pac-12 in 2017 an 2018. Im nem dey for CoSiDA Akademic sekond sekond teem an 2019 United soccer Coaches hol- Amerika sekond team.

LA GALAXY


In March 2019, Plumptre sign to dey pley for UWS wit LA Galaxy OC for di college offseason. Di teem finish sekond in di West Conference.

Leicester City


Shi fest pley for sinior Leicester City on 19 January 2020, e hep Ella Rutherford to skore goal insaid 3 - 1 win wit Crystal Palace. Plumptre no pas three times for League season bikos of coronavirus. Leicester dey nomba six for point by game chekin.

Plumptre komot for Leicester City in July 2023 wen im kontrat finish.

Kontri wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

England


Plumptre don pley for England onda- 15 bifor, onda- 17, onda- 19 an onda- 23 levu bifor, an shi stil pley som oda kompetishon for dem lik: Di 2014 an 2015 UEFA Women's onda- 17 championship. Na shi dey pley front for dem as midfielder for youth levu, shi skore two times insaid 9 - 0 win ova Moldova in di 2015 UEFA Women's Onda- 17 qualifying staj. In 2016, 17 years old Plumptre bi di pesin wey smol for age pas wey im nem go dey insaid Onda- 23 teem for di 2016 La Manga Tournament. Shi sho 30 times at youth levu, shi skore 10 goals.

Naija


Shi tok sey shi go lik pley for Naija sinior team levu in June 2021, dey fest kol Plumptre to kom pley for Naija wen dem dem du eight - day training for Austria. Shi fit pley for Naija bikos im papa na fom Naija an na Yoruba pesin fom Lagos. Shi fes pley for Naija on 23 July 2021, wen e pley for match wey dem pley wit Slovenian 1. SZNL klub olimpija Ljubljana. In December 2021, FIFA komfam am sey e fit pley for Naija. Shi fest pley offisha match for Naija on 18 February 2022.

On 16 June 2023, Shi dey insaid Naija 23 playas wey wan go for 2023 FIFA Women's World Cup.

Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Papa wey bon Plumptre papa na fom Naija. Na Leicester City shi dey sopot wen e dey gro.

Hau e tek wok for teble[chenj-am | chenj-am for orijin]

Klub

As of April 2023

Appearances and goals by club, season and competition
Club Season League FA Cup League Cup Total
Division Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals
Notts County Ladies F.C.|Notts County 2014 FA Women's Super League|WSL 1 2 0 0 0 1 0 3 0
2015 2 0 0 0 5 1 7 1
Total 4 0 0 0 6 1 10 1
Leicester City W.F.C.|Leicester City 2019–20 FA Women's Championship|Championship 3 0 2 0 0 0 5 0
2020–21 19 1 3 4 0 26 1
2021–22 Women's Super League|WSL 20 1 2 Includes appearance in 2020–21 Women's FA 0 3 1 25 2
2022–23 16 0 1 0 3 0 20 0
Total 58 2 8 0 10 1 76 3
Career total 62 2 8 0 16 2 86 4

Honors[chenj-am | chenj-am for orijin]

Notts County

Women's FA Cup runner-up: 2015

FA Women's League Cup runner-up: 2015

USC Trojans

NCAA Division I Women's Soccer Championship: 2016

LA Galaxy OC

UWS Championship: 2019

Leicester City

FA Women's Championship: 2020–21

Wia dem gada di Tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Ashleigh Plumptre Global Sports Archive. Retrieved 18 February 2022.

2. " gets first call as Oporanozie returns". Bbc sport