Jump to content

Asamoah Gyan

From Wikipedia
Asamoah Gyan
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromGana Chenj-am
Nem for lokal langwejAsamoah Gyan Chenj-am
Fest nemAsamoah Chenj-am
Famili nemGyan Chenj-am
Wen dem bon am22 November 1985 Chenj-am
Ples wey dem bon amAccra Chenj-am
Broda an sistaBaffour Gyan Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Ga, Twi, Ghanaian Pidgin English Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialityforward Chenj-am
Wie e go skulAccra Academy Chenj-am
Wen e stat wok2003 Chenj-am
End of work period20 June 2023 Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
Sport number35 Chenj-am
League or competitionPremier League Chenj-am

Asamoah Gyan (Dem bon am on 22 November 1985) na Ghanian forma futbola wey pley as strika. Na im bi di forma captain for Ghana nashonal teem.

Gyan stat to dey pley in 2003 wit Ghana Premier League Klub Liberty profeshonal wia e store ten goals insaid sixteen match e kon uze three season wit Seria A Klub Udinese fom two season loan for Modena e skore fifteen taims insaid 53 league match an wen e dey Udinese e skore 11 taims insaid 39 league match. In 2008, Gyan go Ligue 1 klub Rennes. e skore fourteen taims insaid 48 league match for two seasons.

Insaid 2011, Gyan go Al Ain of di UAE pro League for loan an na im kon bi di pesin wey skore pas for di league, e skore 22 taims insaid 18 matches wey e pley. Di season wey folo, Gyan go Al Ain pamanet an hep dem win di Pro League, na im stil bi di pesin wey skore pas for di league, e skore 31 goals insaid 22 matches. In di 2014 - 14 league season, na Gyan bi di pesin wey skore pas for di league wey mek am di third taim, wit 29 goals insaid 26 matches.

Na Gyan skore pas for Ghana nashonal teem, e get 51 goals. E dey insaid playa wey pley for Ghana insaid 2006, 2010 an 2014 FIFA Wod Kups. Wit 6 goals, na im bi di Afrika playa wey skore pas for Wod Kup. Gyan don pley for Ghana insaid di 2014 summer Olympics an insaid seven Afrika Kup of Nashons in 2008, 2010, 2012, 2013, 2015, 2017 an 2019, e hep dem kom third - ples in 2008 an sekond in 2010 an 2015. Na on 20 June 2023 Gyan tel Poblik sey e no wan stop to dey pley aktiv futbol.

Im Pasonal life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Gyan bi di las bon for im papa an mama, Baffour Gyan Mensah (papa), an im mama wey don kpai Cecilia Amaoko. Im sinior broda, Baffour Gan sef dey pley futbol. Gyan Mari Gifty Gyan an dia two bon three pikin, wey dia nem na, Rafael Gyan, Fedrick Gyan an Floyd Gyan.

Tins e lik Apat futbol

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Boxing

In June 2012, Gyan stat to dey wan let pipu no sey Ghana get ogbonge boxer an sey e go dey sponsor boxing sho for Ghana.

Insaid February 2021, kontrat wey Bay Jet promotions du wit Emmanuel Tahoe no go wel. Di kontrat sopos stat on October 2018 an end November 2021.

Baby Jet Airline

For October 2017, dem giv Asamoah Gyan Air Carrier license (ACL) na Ghanian Civil Aviation Authority (GCAA) giv am.

Tennis

E stat to dey pley Table tennis in 2020 web e get injury. Baby Jet promotions an MACWA Commodities du tournament for hep Di sport gro.

Hau e tek wok for teble

[chenj-am | chenj-am for orijin]
Appearances and goals by club, season and competition
Club Season League National Cup League Cup Continental Other Total
DivisionAppsGoalsAppsGoalsAppsGoalsAppsGoalsAppsGoalsAppsGoals
Liberty Professionals 2003 Ghana Premier League 16101610
Udinese 2003–04 Serie A 100010
2006–07 Serie A 25810268
2007–08 Serie A 13300133
Total 3911101010004011
Modena (loan) 2004–05 Serie B 28700287
2005–06 Serie B 25810268
Total 5315100010005415
Rennes 2008–09 Ligue 1 1612010Appearance in UEFA Cup0201
2009–10 Ligue 1291310003013
2010–11 Ligue 130000030
Total 4814301010005314
Sunderland 2010–11 Premier League 311010113311
2011–12 Premier League 30001040
Total 3410102100003711
Al Ain (loan) 2011–12 UAE Pro League 18221253002427
Al Ain 2012–13 UAE Pro League 22312000Appearances in AFC Champions League}}11Appearance in [[UAE Super Cup]}02932
2013–14 UAE Pro League 26294620121204547
2014–15 UAE Pro League 1713140065102522
Total 839581273221830123128
Shanghai SIPG 2015 Chinese Super League 10411115
2016 Chinese Super League 103100153
Total 20721004000268
Shabab Al-Ahli (loan) 2016–17 UAE Pro League 146103372102611
Kayserispor 2017–18 Süper Lig 12153174
2018–19 Süper Lig 14431175
Total 26584000000349
NorthEast United 2019–20 Indian Super League 8484
Legon Cities 2020–21 Ghana Premier League 601 070
Career total 3471772617137342040424221

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Asamoa-Gyan quits Blackstars..www.graphic.com.gh. 20 May 2019. Retrived August 28 2023.