Table tennis

From Wikipedia
Table tennis
type of sport
Subclass ofball game, racket sport, Olympic sport Chenj-am
Inception1891 Chenj-am
NameGossima, Ping Pong Chenj-am
AuthorityInternational Table Tennis Federation Chenj-am
Country of originEngland Chenj-am
Described at URLhttps://neal.fun/earth-reviews/table-tennis, https://www.bouncepingpong.com/about Chenj-am
Practiced bytable tennis player, table tennis coach Chenj-am
Usestable tennis racket, table tennis ball, table for table tennis Chenj-am
Unicode character🏓 Chenj-am
Alternative namePing-Pong Chenj-am

Table tennis, wey dem stil sabi as Ping-pong an whiff-whaff, na racket sport wey kom fom tennis but dey difren bikos of di teble wey dem dey uze pley am. If na one pesin dey pley am or two team, playa dey pley bak to di sekond pesin ova di net wey dey ontop teble wit dia smol racket ontil dem no fit pley bak again, dat go bi point for di oda pesin. Dem dey pley am fas fas, pesin dey cirious wit am bikos u go pley am bak fas fas, an di bol wey dey dey use dey fas sef.

If dem wan pley table tennis na smol ples dem dey pley am bikos di teble no dey tu big, Dem dey pley am insaid haus onda eni weather. Na for di hol wod dem like teble teniss bikos no bi for onli competition sport, u stil fit uze am du exercise an pley am for any age.

Table tennis don bi Olympic sport sins 1988, an di event dey for men's and wumen's single, an men's an wumen's teams wey reples double in 2008.

Pipul wey dey in cherj for di wod na International Table Tennis Federation (ITTF), wey Dem stet for 1926, an rait di rules insaid ITTF handbook. ITTF get 226 members association for di hol wod.

Histri[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di sport stat in Victorian England, na pipul wey get moni wel wel stat am an dem dey pley am afta nait fud as parlour game. Som pipul don tok sey na British military wey dey India for 1860s or 1870s join mek am gro. Dem du one tin for middu wey dey as net, dem du anoda two tins lik buk wey dem dey uze as racket to pley di bol.

Di nem "Ping-pong" wey dem dey kol am na wetin pipul don no bifor J.Jaques & Son Limited mek am dia own rait in 1901. Plenti pipul lik to dey kol di game nem Ping-pong pas mek dem dey kol am wetin Jacques tins, som of di kompini wey dey du tins lik to dey kol di game table tennis.

Anoda tin wey dem add to di game na di Kain bol wey dem dey uze an na James W. Gibbs diskova am for 1901 wen e go US. Na E.C Goodie for 1901, diskova niu rocket wey dem go uze dey pley di game. Plenti pipul don dey sabi table tennis for 1901 sotey dem du kompetition, rait buk about am, an wod championship hapun for 1902. Na hau dem dey tek giv lawn tennis points dem dey uze for am tu.

Na two Association dey for 1902 wey bi: "Ping-pong Association" an "Table tennis Association" for 1910, niu table tennis association kon dey for 1921, dem kol am English tennis Association for 1926. Di International Table tennis Federation (ITTF) folo in 1926. Na for London dem du dia fest wod championship in 1926. In 1933, Di United Table tennis Association, wey dem dey kol USA table tennis now, stat.

In di 1930's, Edgar Snow tok insaid Red Star over China sey som beta pipul lik di English game of table tennis. For Soviet Union, in di 1930's dem don sabi di sport bikos dem alow mek soldiers dey du Sport, an bikos di game dey hep pesin get beta bodi