Aremu Afolayan
Hau e go bi
Aremu Afolayan
| Man abi wuman | man |
|---|---|
| Wen dem bon am | 2 August 1980 |
| Ples wey dem bon am | Ebute Metta |
| Papa | Adeyemi Afolayan |
| Broda an sista | Kunle Afolayan, Anu Afolayan |
| Wok wey e dey du | actor |
| Wie e dey liv | Abuja |
Aremu Afolayan (bon August 2, 1980) na Naija fim aktor an broda of Kunle Afolayan wey bi popula fim aktor an awod-winnin daretor an bizness owna.
How e tek stat life an karia
[chenj-am | chenj-am for orijin]Aremu Afolayan kom from Kwara state, Ìgbómìnà-Yoruba.E bi one of di pikin of di popula tiata, fim daretor an produsa Ade Love.Pipu no am for di fim wey e du wey di nem na "Idamu Akoto" (2019).
pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Aremu Afolayan marri Kafilat Olayinka Quadri. Dem bon one pikin wey ha nem na Iyunade Afolayan