Anthony Joshua

From Wikipedia
Anthony Joshua
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromUK Chenj-am
Country for sportUK Chenj-am
Orijina nemAnthony Oluwafemi Olaseni Joshua Chenj-am
Fest nemAnthony Chenj-am
Famili nemJoshua Chenj-am
Wen dem bon am15 October 1989 Chenj-am
Ples wey dem bon amWatford Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey duboxer Chenj-am
Wie e go skulKings Langley School, Mayflower School Chenj-am
Wen e stat wok5 October 2014 Chenj-am
Sportboxing Chenj-am
Sports discipline competed insuper heavyweight, heavyweight Chenj-am
Participant inboxing at the 2012 Summer Olympics – men's super heavyweight, Anthony Joshua vs. Andy Ruiz Jr., Anthony Joshua vs. Oleksandr Usyk Chenj-am
Country of originNaija Chenj-am
Awod wey e koletMember of the Order of the British Empire, WBO World Heavyweight Champion, WBO World Heavyweight Champion Chenj-am
Official websitehttp://www.anthonyjoshua.com/ Chenj-am
VictoryAnthony Joshua vs. Joseph Parker, Anthony Joshua vs. Wladimir Klitschko, Andy Ruiz Jr. vs. Anthony Joshua II, Anthony Joshua vs. Alexander Povetkin, Anthony Joshua vs. Kubrat Pulev Chenj-am

Anthony Oluwafemi Olaseni Joshua OBE (bon 15 octoba 1989 ) na british profeshonal boxer. Na two time foma unified world heavyweight winna, wey im get WBA (Super), INF, WBO, and IBO title for two times from 2016 to 2121. For regional level, im get di British an Commonwealth heavyweight titles fom 2015 to 2016. As pesin wey jost stat, Joshua represent England for 2011 World Championships in di supa heavyweight level an e win a silver medal. E olso represent Great Britain for 2012 Olympics wey bi sey e win gold. For 2014, afta one year wey wey bi sey e don bikom profeshonal, Dem kom give am di awod wey bi ''Prospect of the Year'' by di ring magazine. For 2017, im win one fight wey mek pipul no am wel wel an na against Wladimir Klitschko di fight bikom fight of di year by di Ring an di Boxing Writers Association of America. Joshua na di sekond English boxer, afta James DeGale wey go win gold medal for Olympicss an World title by a mejor profeshonal sanctioning bodi, an im still bikom di fess English heavyweight wey go du so.

For Octoba 2022,Dem rank Joshua as di World sekond bess aktiv heavyweight by BoxRec third byDi Ring, an fourth by Translational Boxing Ranking Board an ESPN, as wel as di sixth-bess aktiv boxer Pound for Pound by BoxRec. BoxRec don rank am as among di World top 10 heavyweight sins 2014, an dem rank am as no. 1 when 2016 an 2017 finish. Joshua knockouts to win pasentej na 88% an e get ovarol parsentej wey bi 58% for wod heavyweight title fight.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Anthony Oluwafemi Olaseni Joshua for Octoba 15, 1989 for Watford, Hertfordshire an na di son of Yeta an Robert Joshua. Im mother na Nigerian, an im fada na Nigerian an Irish pesin. Joshua orijin na fom Yoruba pipul for Naija. Im famili memba wey bi Ben Ileyemi wey olso bi profeshonal boxer too. Di two of dem stat to dey fight profeshonali for di sem time for 2013. Joshua yuz som of im years for Naija wen im stil dey smol as a boarding student at Mayflower School for Ikenne. Im papa an mama live diaself wen e dey 12 years old e Kon go bak to UK wen e dey seven years old to join Kings Langley Sekondri Skul. As e dey kontinue to dey gro for Meriden Estate for Garston Hertfordshire, for dat ples all im frens an im foma tisha dey kol am Femi bikos of im middle nem wey bi Oluwafemi. E olso du wel for Football an Athletics wey kom mek im brek rekod of nine years for im skul for 9 years 100m race rekod wit a time of 11:6 sekons.

Im Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Joshua sabi lik to dey pley chess an mek e dey reed bikos na wetin dey hep am sabi faight wel. Na haus e dey hep pipu du bifor e stat to dey faight boxing.

In 2009, dem put Joshua for prison bikos of faight an som oda krazi tins wey e du. Dem put eletric bag for im leg wen e komot for di prison.

In March 2011, polis kach Joshua bikos e dey draive kar too fas in Colindale, North London. Dem ci eight ounces (22.68 grams) of cannabis insaid im sport bag. Dem kari am go court bikos e dey kari wetin govarmet don band, na 14 years dem dey giv pesin wey du am for prison. Dem stop Joshua mek e no faight for GB boxing squad an dey giv am 12 months komuniti oda an 100 hours wey go tek wok an dem no go pay am, afta e don tok sey e no du wetin dem tok abaut am.

Joshua for 2012 tok sey e no dey sopot eni futbol teem, for intavew wey e du for 2017, e tok sey na Watford F.C e dey sopot, an di teem wey e lik pas na Real Madrid bikos of Christiano Ronaldo, Ronaldo dey for Real Madrid dat time. For insaid dat sem intavew e tok sey English futbola Troy Deeney, wey e ci for wia dem dey cut hair na im bes frend.

Insaid intavew wey e du wit iFL TV in July 2014, Joshua kol Muhammad Ali, Mike Tyson, Larry Holms, Lennox Lewis, an Evander Holyfield nem as di five bes heavyweight boxers of hol time.

Joshua bon one pikin, im nem na "JJ" Joshua, wit dans ticha Nicole Osbourne, in 2015.

In 2020, tok gud tins abaut im promota Eddie Hean, wey don dey promote am sins 2013.