Jump to content

Aminu Waziri Tambuwal

From Wikipedia
Aminu Waziri Tambuwal
pesin
Part ofHouse of Representatives of Nigeria Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejAminu Waziri Tambuwal Chenj-am
Orijina nemAminu Waziri Tambuwal Chenj-am
Fest nemAminu Chenj-am
Wen dem bon am10 January 1966 Chenj-am
Ples wey dem bon amTambuwal Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Hausa langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, lawyer Chenj-am
Post wey e deySpeaker of the House of Representatives of Nigeria, member of the House of Representatives of Nigeria, Governor of Sokoto State, member of the House of Representatives of Nigeria, member of the Senate of Nigeria Chenj-am
Wie e go skulUsmanu Danfodiyo University Chenj-am
Academic degreeBachelor of Laws Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
ReplacesDimeji Bankole Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Aminu Waziri Tambuwal (dem bon am on January 1966) na Naija lorya an politishan wey don sarf as Senato for Sokoto Sauth in 2023. E don sarf as Sokoto Stet Govnor don 2015 rish 2023. Na memba of People's Demokratic Parti, an e don sarf as di 12th Spika of di Hauz of Representatives of Nigeria fom 2011 rish 2015. E don sarf as Sokoto Stet Govnor don 2015 rish 2023. Na memba of People's Demokratic Parti, an e don sarf as di 12th Spika of di Hauz of Representatives of Nigeria fom 2011 rish 2015.

Tambuwal dey stan for Tambuwal/Kebbe Fediral Constlistuenci of Sokoto Stet as hinorabu memba insaid di Hauz of Representatives fom 2003 rish 2015.

How e stat life an edukashon

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Aminu Waziri Tambuwal on 10 January 1966, insaid Tambuwal Vilej in Sokoto Stet, to Fatima an Waziri Tambuwal.

E go Tambuwal Primari Skul, Tambuwal, Sokoto Stet, wia e get im Fest Skul Leaving Certifikate in 1979, an Govmet Teachers' College, Dogon Daji,wia e get Teachers Grade II Certifikate in 1984. E go Usman Dan Fodio Universiti Sokoto, wia e stodi lor,e finish wit LLB (Hons) digre in 1991. E finish im one year legal stodi wey e du for Nigerian Law Skul, Legos, e get BL an dey kol am to Bar in 1992.

E stodi som oda tins apat fom lor, ego difren course for anoda kontris, som of dem na; Telecoms Regulatory Masta Klass–Bath UK, 2004; Lawmaking for di Communicashons Sectors –BMIT, Johannesburg, South Africa, 2004; Regulating a Competitive Industry-UK, Brussels, 2005; Tulane University – Internashonal Legislative Drafting, 2005; Stanford Graduate Skul of Biznes – Influence an Negotiashon, 2008 and KSG Harvard – Infrastructure in Market Ekonomi.

Big koneshon e get

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Apat fom im wok koneshon, Tambuwal na beta memba wey dey wok for Nigerian Bar Association for 8 years. Memba, Di Nigerian Bar Associashon

Poblik Relations Ofisa, Di Nigerian Bar Associashon (1996-1997)

Memba, Constitushon Review Committee of di Nigerian Bar Associashon (1997-1998)

Sokoto Branch Secretary, Nigerian Bar Associashon (1997-1998)

Assistant Nashonal Financial Secretary of the Nigerian Bar Associashon (1998-2000)

Fest Assistant Nashonal Sekretary of Nigerian Bar Associashon (2000-2002)

Memba, Bodi of Benchers Nigeria

Memba, Internashonal Bar Associashon

Member, American Bar Association