Amaju Pinnick

From Wikipedia
Amaju Pinnick
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am1 December 1973 Chenj-am
Ples wey dem bon amDelta State Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Benin Chenj-am

Amaju Melvin Pinnick (dem bon am 1 December 1970) na Naija pesin wey bi presidor of NFF (Naija Futbol Fedireshon) from 2014 go rish 2022. Dey chuz Pinnick as NFF presidor in September 2014 an dey still chuz am to kontiniu on 20 September 2018. Di man stil bi di fest vais-presidor of di CAF (Konfidereshon of Afrika Fedireshon) from September 2018 go rish July 2019. Pinnick na stil memba of di Organisin Komiti for FIFA kompetishon.

How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Pinnick for 1 December 1970. E papa mari meni wife an bon 19 pikin-dem. Pinnick get famili blood with Chief Joe an pa Johnson O.S Ayonmike wey don kpai bikos e mama kom from Ayonmike famili. Pinnick go Hussey Kolej Warri an na for di skul e tek rait e WASC. For 1994, Pinnick kolet e satifiket from Yunivasiti of Benin afta e don rid Politika Sayensi an Poblik Hadiministrashon.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pinnick fest stat to dey wok as di chairman or lida of Delta Stet Futbol Hassosiashon in 2011. Dem kom chuz am as di presidor of NFF on 30 September 2014.

For 20 September 2018, dey chuz am mek e yuz anoda four years kontiniu to bi di chairman or lida of NFF for mitin wey dem do for Kastina Stet.

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pinnick wife nem na Julie Pinnick an di marej produs four pikin-dem.