Jump to content

Nigeria Football Federation

From Wikipedia
Nigeria Football Federation
association football federation
Inception1945 Chenj-am
Native labelNigeria Football Federation Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Coordinate location9°1′56″N 7°26′45″E Chenj-am
Memba ofFédération Internationale de Football Association, Confederation of African Football, West African Football Union Chenj-am
Parent organization or unitWest African Football Union, Confederation of African Football Chenj-am
FIFA country codeNGA Chenj-am
Map

Di Nigeria Football Federation( wey dem sabi as Nigeria Football Association til 2008) na im bi Naija futbol govnorin bodi. Dem stat am for 1945 an dem no am as Nigeria national football team in 1949. E join CAF in 1959 an FIFA in 1960. Dia head ofis dey Abuja.

For 2018 na three league e dey kontrol: Di Nigeria Premier League, Di Amateur League an di Women's League, an five competishion, Federation Cup an Women's Cup folo. Dia nes elecshion na 2022.

Katakata wey hapun wen dem stat am

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pesin wey sabi rait nius wel wel for Naija, Solaja don ci evidens sey na 1933 dem sopos don stat am no bi 1945 wey pipul dey tink.

Solaja menshion two Nigeria Daily times wey tok about di mata, one na 21 July an 21 August 1933. Di fest na about hau dem dey plan to stat am di oda one na wen dem dey kol pipu to kom join dem.

Di FA's poblic Affairs Ofisa David Berber, tel pipu sey di FA get pruf sey di Nigerian Football Federation don dey bifor 1945.

On di 9th July 2014, afta di 2014 FIFA Wod cup, Nigeria get suspenshion fom FIFA, wit wetin FIFA tok dem sey di suspenshion na bikos dem kari NFF go kourt kon tel dem mek dia president no kontrol again.

Nigeria stat to dey pley bak for FIFA competishion in 2014 FIFA U-20 Women's wod cup.

In September, anoda wahala stat wey mek Nigeria mis 2015 Afrika Cup of Nations, but dem leta setu am, an Nigeria leta go 2014 Africans Women's championship.

Nigeria Football Federation Bill

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Rules an lors wey dem go dey folo wey go mek dem komfam Nigeria Football Federation ("NFF ACT"), na wetin National Assembly of Nigeria don tok abuat in 2019. Na for onli mek President Muhammadu Buhari sign am mek e bi lor e remain.

Wai dem Neva sign di NFF Bill

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Plenti pipu for Naija wan mek dem sign di Bill, bikos dem tok sey e go hep mek Naija futbol gro. But pipu wey sabi lor tok sey for Naija lor no bi National Assembly sopos put mouth for di mata. An anoda tin bi sey if president sign am na im bi sey FIFA no go tu get pawa ontop am, an dis one no folo for FIFA rules.

NFF Presidents

[chenj-am | chenj-am for orijin]
NFF Presidents
YearKontriName
1945-1947EnglandPA Mulford
1947-1948EnglandPius Quist
1949-1950EnglandD.H. Holley
1951-1953EnglandP Harvey
1954-1956EnglandN. Miller
1957-1958EnglandDennis J. Slattery
1959-1960EnglandR.B Allen
1960-1961NigeriaGodfrey Amachree
1961-1962NigeriaF.A.S. Ogunmuyiwa
1962-1963NigeriaLouis Edet May
1963-1963(Acting)NigeriaM.S. Adewale
1963-1963(Acting)NigeriaA.B. Osula
1964-1964NigeriaFrancis Giwa Osagie
1965-1965NigeriaIshola Bajulaiye
1965-1967NigeriaChuba Ikpeazu
1967-1970NigeriaGodfrey Amachree
1971-1971NigeriaKevin Lawson (col.)
1971-1972NigeriaEdwin Kentebbe (Comdr)
1972-1972NigeriaAdemola Adeoba
1973-1973NigeriaEmmanuel Sotomi (Brig)
1974-1980NigeriaSunday Dakore
1981-May 1982NigeriaMike Okwechime
1982-1983NigeriaEdwin Kentebbe (Comdr)
1983-1987NigeriaTony Ikazoboh
1987-1988NigeriaJohn Obakpolor
1988-1989NigeriaChuba Ikpeazu
1989 (interim)NigeriaEfiom Okon
1989NigeriaTony Ikazoboh
1990-1991NigeriaYusuf Ali
1991-1992NigeriaEfiom Okon
1992-1993NigeriaAmos Adamu
1993-1997NigeriaEmeka Omeruah
1997-1999NigeriaAbdulmumuni Aminu
1999NigeriaKojo Williams
1999-2002NigeriaDomenic Oneya
2002-2006NigeriaIbrahim Galadima
2006-2010NigeriaSani Lulu
2010-2014NigeriaAminu Maigairi
2014-2022NigeriaAmaju Pinnick
2022NigeriaIbrahim M. Gusau

Wia Dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. The Business of Football -THISDAYLIVE. www. thisdaylive.com.Retrived 20 May 2023