Jump to content

Alvan Ikoku

From Wikipedia
Alvan Ikoku
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemAlvan Chenj-am
Wen dem bon am1 August 1900 Chenj-am
Ples wey dem bon amArochukwu Chenj-am
Wen e kpai18 November 1971 Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Wie e go skulHope Waddell Training Institution, University of London Chenj-am

Alvan Azinna Ikoku (wey dem bon for 1 Ogost 1900, an e kpai for 18 Novemba 1971) na Naija pesin wey bi politishan, pesin wey dey stand gidigba an fait for pipul rait, an pesin wey dey sopot edukeshon mata.

Tori abaut im laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am for 1 Ogost 1900, for one taun wey dem dey kol Amanagwu Arochukwu, insaid di ples wey bi Abia Stet todey, an e go Arochukwu Government Primary School from 1911 rich 1914. From 1915 rich 1920, e go Hope Waddell College for Calabar wia one ticha wey im nem na James Emmanuel Aggrey tich am, an e an Akanu Ibiam togeda wit Eyo Eyo Esua dey di sem klas dat taim. For 1920, e get im first job to tich skul onda di Presbyterian Church of Nigeria an di Church of Scotland for one ples wey dem dey kol Itigidi. Afta two yias don pas, e bikom sinio ticha for St. Paul's Teachers' Training College, wey dey for Awka insaid Anambra Stet. As e dey tich skul for Awka so, Ikoku rid buk ontop hau pipul dey tink abaut laif to get big satifiket from di University of London for 1928, bikos e rait di igzam from far.

For 1932, Ikoku biud di first sekondri skul for West Africa wia boi-dem an gel-dem dey len insaid di sem klas: di skul nem na Aggrey Memorial Secondary School, wey dey for Arochukwu an e giv am dat nem bikos of im gud ticha James E.K. Aggrey, wey bi one skul ticha from Ghana wey Dem sabi wel wel. For 1946, afta plenti chenj enta di lo buk to alau mor Nigeria pipul sit-daun insaid di lo haus, dem chuz am mek e join di Eastern Nigeria House of Assembly an dem put am insaid di ministri of edukeshon. For 1947, e join di big grup wey dey mek lo for Lagos as one of di three pipul wey stand for di Eastern pat of di kontri.

Ikoku mek di govment put ai an maind wel-wel for di grup of Nigeria skul ticha-dem wey dem dey kol Nigeria Union of Teachers (NUT), an na im mek di big lo haus gri for 44 tins wey di NUT tok sey mek dem chenj insaid di skul lo buk. Tru tru, e si big big wahala for insaid meni yias for 1950 go rich 1959, bikos di oyibo pipul govment dat taim no gri for di tins wey im NUT grup tok sey mek evri skul for Nigeria dey du di sem tin. Afta di kontri get fridom to rul diasef, di govment si sey wetin Ikoku an im grup tok na tru, bikos na dat sem tin na im dem tek mek di skul lo-dem for di niu kontri.

For 1962, e beg mek dem bring aut one strong lo wey go alau evri smol pikin go pramari skul fri witaut sey dem go pay moni for six yias for evriwia for Nigeria. Di big soja-dem wey dey rul di kontri gri for dis tok leta from 1976 go front. Todey, fri skul for evri pramari skul na wetin dem don giv evribodi finish. Dr Ikoku stil dey stand as one big ezampul for hau buk lanin an skul biznes dey gro for Nigeria, an e na one of di skul ticha-dem wey sabi pas wey Nigeria don eva get sins dem bon di kontri.

Wen e stop to dey du govment politishan wok, Ikoku sav for insaid difren difren grup-dem wey dey luk afta skul mata for di kontri. E bi memba for di West African Educational Council (WAEC) an di grup wey dey kontro di University of Ibadan, an e stil bi di chiaman for di grup wey dey rul di ples wia dem dey tren pipul hau to draiv eroplen.

Respet wey dem giv am

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di gud tins wey dem tek giv am respet bikos of hau e hep skul biznes for Nigeria na one big honorary degree to kol am Doctor of Law (1965) for one speshal grand for di University of Ibadan, an dem stil biud one big skul for ticha-dem wey dem kol Alvan Ikoku Federal College of Education, an one big rod wey bi Alvan Ikoku Way, for Maitama insaid Abuja for Nigeria an dem put im pisho ontop Nigeria pepa moni, wey bi di Ten Naira pepa moni. E kpai for Novemba 18, 1971.

Dem stil put im fes insaid di 10 Naira pepa moni sins 1979.

Wie dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]