Akin Busari

From Wikipedia
Akin Busari
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Wen dem bon am20 August 1986 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Wok wey e dey dusinger-songwriter Chenj-am
Wen e stat wok2009 Chenj-am

Akin Busari (dey bon am 20 August 1984) wey pipo no wel wel as Akin na Naija singa, song raita an produsa. Na Akin win di 2012 Afrika Entatenmet Awod wey hapun in Canada. Na e bi di oga patapata for "Influential Music". Pipo no Akin wel wel bikos of di song wey e sing like "Harmony", "Nigerian Girl", "Bamijo", "Omo Ele".

How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Ikeja, Legos Stet dey bon Akin Busari on 20 August 1984. Akin kom from Yoruba tribe. E go Command Day Sekondiri Skul . Canadian Bizness Kolej give Akin komputer Skolaship to go rid for Canada an e traful go dia in 2003.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akin tok sey na singa like 2face, Fela, an Wyclef mek am like to bikom muzikshan. E tok sey di way e mama like muzik mek am start e muzil karia. Akin tok sey na wetin dey hapun for life e dey tek sing for e muzik. E tok sey if we wan mek di wold beta, na to join bodi helep one anoda an do awa pat.

Song wey e don do[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • True Stories (2009)
  • Mo So Rire (2011)
  • Strength (2012)
  • Babylon Soldier (2012)
  • Brand New Day ft. J.Robb (2012)
  • The Way You Are (2012)
  • Radio Killer ft, Yom (2013)
  • Beautiful (2013)
  • Harmony (2014)
  • Nigerian Girl (2014)
  • Aja (2016)
  • Bamijo (2016)
  • Omo Ele (2016)
  • Be With You ft. Neza

Awod-dem wey e don kolet[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • E win Best Toronto R&B/Soul Song an Best Toronto Hip Hop Song Toronto Exclusive Awod in 2009.
  • E win Best Toronto R&B Soul Song in 2010.
  • E win Best Aktist at Afrika Entantemet Awod in 2012
  • E nem de for di katigori wey fit win Black Canadian Awards in 2015.
  • E nem de for di katigori wey fit win Best song at di Independent Music Award in 2015. Na di song Harmony mek dem put e nem dia onda di katigori "Sing out for Social Action.