Ago-Oba

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Ago-Oba na elektora wod 13 for di siti of Abeokuta Ogun stet Nigeria.

Location[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ago-Oba (kamp of di Oba) na komuniti wey di Owu sektshon of Abeokuta pipul dey klem sey dem kom from di old oba kindom.E no kle weda dem form Ago-Oba wen dem muv kom dia during di 19th sentury Yoruba wori weda di pipul don kom there bifor dat time.

Di men ekonomik wok wey dem dey do na textile making, artisan wok an to dry yus Moto dey Kari things. There houses for Ago-Oba na six to twenty dey stey an dem dey yus shalow well for wota. Dis wota no mit World health Organization standard an if dem no trit di wota e dey cos sirios health risk. For di past di wota get subject wey be perennial flooding but recently di komuniti don mek efot to see sey dem improve di drainage. Di Anglican community for Ago-Oba parish sav for st Michael's church.

Important pipul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Foma Ogun stet govnor Olusegun Osoba hod di tradishona title wey be Otun of Ago-oba among oders. For April 2011 presidential election Osoba kast im vote for Ago-Oba for kandidate Nuhu Ribadu of di Action Congress of Nigeria. Ribadu na dem tok di wina for di wod wit 142 votes to 65 for PDP and 5 for CPC. Foma president Olusegun Obasanjo im be Owu pipul. Wen im wife Stella Obasanjo die for 2005, dem kari di bodi from Legos kom winners chapel for Ago-Oba from there dem kom Kari ha go beri for Obasanjo famili kompound wey dey near ita-Eko. Alexander Adebayo Bada (1930-2000) sekond lida for di Celestial Church of Christ Worldwide im na son of di Baale or Paramount hed of Ago-oba foma president of di Ikeja customary court for Lagos. Di seriki of Egbaland, Dr. Lateef Adegbite get im Ofis for Ago-oba.

Were we gather the tori[chenj-am | chenj-am for orijin]