Adeniran Ogunsanya

From Wikipedia
Adeniran Ogunsanya
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am31 January 1918 Chenj-am
Ples wey dem bon amIkorodu Chenj-am
Wen e kpai22 November 1996 Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dulawyer Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Manchester, King's College, Lagos, Victoria University of Manchester Chenj-am

Adeniran Ogunsanya, QC, SAN (Dem bon am for January 31, 1918 an e dai for November 22, 1996) na Naija lorya an politishan. E join bodi fom Ibadan Pipul Parti (IPP). E saf as di oga kpata-kpata for pipul wey dey joj mata for kot an for skul mata for Legos Stet. For di sekond ripublik, im na di oga kpata-kpata for di Nigeria People's Party.

Tori of e laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am for one pat of Legos wey bi Ikorodu for January 31, 1918 insaid one famili wey dey rul wey bi Omoba Suberu Ogunsanya Oguntade wey bi di Odofin of Ikorodu. E finish im primari skul for Hope Waddell Training Institute for kalabar an na one of im papa broda wey dey wok for govament train am.Wen dey rait di Govament Standard VI ezam for 1937, na Adeniran Ogunsanya get mark wet hi pas. Dis one kom mek govament pai for all e skul moni an buk as dem send am go King's College for Legos. Adeniran stil go rid lo for big big skul laik University of Manchester an Gray's school of law.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta e kom bak fom United Kingdom, Adeniran fest stat to dey wok as pesin wey dey joj pipul mata for kot for Chief T.O.S Benson Chambers an e stil bi politishan. For 1956, e and im broda wey e nem na Sulu Ogunsanya join bodi togeda to stat Ogunsanya & Ogunsanya Chambers.

How e tek du politiks[chenj-am | chenj-am for orijin]

As dem dey for di middu of 1950, Adeniran Ogunsanya folo for pipul wey wok for di National Executive Committee for inside di National Council of Nigeria and the Cameroons(NCNC). Na Adeniran bi di oga kpata-kpata for di Youth Association an e kom bi pat of di pipul wey go stand for Ikeja an Mushin pipul for parliament for 1959. Adeniran wok for plenti plenti post for insaid di politikal parti wey im dey an im kom stil wok for lokal govament for Legos. For insaid NCNC, e get one taim wey im bi di oga kpata-kpata for di pipul wey dey wok for di one wey dey Legos Stet.Adeniran stil bi di zonal oga for koloni provins an afta, e kom bi di seketri for di pipul wey bi sey na dem bi di oga dem for NCNC.E bi oga for smol smol politiks laik di Mushin District Council Management Committee. Bifor di fest ripublik finish, dem mek am di oga pata-pata for pipul wey dey du house and land mata for di hol Naija. Wen Mobolaji Johnson bi di lida, dem kom mek Adeniran di oga pata-pata for skul mata for di hol Legos stet. Im bi di oga pata-pata for di Legos progressives wey kom stil folo three oda grup join-bodi to form di Nigeria People's Party (NPP) for di Sekond Ripublik. Bifor Adenira Ogunsanya bi di oga pata-pata for di Nigeria People's Party (NPP), e don fest kontest wit Lateef Jakande bot Adeniran no win. Bot wen Olu Akinfosile don bi oga pata-pata for NPP finish, Adeniran kom bi di next oga pata-pata for NPP.Adeniran bi di fest Attorney General for di hol Legos an e kom lẹta bi di oga pata-pata for skul mata for di hol Legos.

How pipul tek dey rimemba am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bikos of di way im put bodi wel wel to mek Legos Stet beta, dem yuz im nem for one big skul for Legos wey dem dey kol Adeniran Ogunsanya College Of Education. Adeniran na also Senior Advocate of Nigeria (SAN) an stil get one beta tin as lorya wey dem dey kol Queen's kounsel.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]