Ademola Adeleke

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Ademola Adeleke
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemAdemola, Jackson Chenj-am
Famili nemAdeleke Chenj-am
Wen dem bon am13 May 1960 Chenj-am
Ples wey dem bon amEnugu Chenj-am
PapaRaji Ayoola Adeleke Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deymember of the Senate of Nigeria, Governor of Osun State Chenj-am
Wie e go skulJacksonville State University Chenj-am
Academic degreeBachelor of Science Chenj-am
Academic majorcriminal justice, political science Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am

Ademola Nurudeen Jackson Adeleke (dem bon am for May 13, 1960) na Naija politishian wey dem bon for Enugu Siti. E na one taim senator wey bin don repiset Osun-West Senatorial District fom 2017 kom rish 2019.Adeleke bi memba of di popula Adeleke famili of Ede insaid Osun Stet. Na Adeleke win 2022 Osun State Gubernatorial Election afta e win Adegboyega Isiaka Oyetola wey bi di preset Gofnor. Adegboyega Isiaka Oyetola don fest win Ademola Adeleke for di 2018 Osun State Gubernatorial Election rerun.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adeleke du e pamari skul for Methodist Primary School, Surulere Lagos State bifor e go Oyo Stet wia e go Nawarudeen Primary School, Ikire.Adeleke fom dia enta Seventh Day Adventist Secondary School, Ede wey dey Old Oyo Stet an e leta go Ede Muslim Grammar School Ede, wia e finish e sekondiri skul. Afta Adeleke do e sekondiri skul finish, e go United States of America (USA) go join e two elda broda. Na for I said USA e go rid Criminal Justice an Political Science for Jacksonville State University, Alabama. Afta wen meni wahala bikos dey tok sey e no kolifae to bi gofnor bikos e no get satifiket, Adeleke go Atlanta Metropolitan State College insaid USA wie e go get e Bachelor of Science Degree in Criminal Justice for 2021.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pat of wok wey Govament no dey put hand[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adeleke na biznesman an administrator wey bin don saf as Executive Director of Guinness Nigeria Plc fom 1992 go rish 1999.Som of di oda pipul wey folo am daret di kompini bi General Theophilus Danjuma.Adeleke don also saf as Group Executive Director for Pacific Holdings Limited wey bi e broda kompini fom 2001 go rish 2016.Bifor Adeleke enta Pacific Holdings Limited, e don wok as Service Contractor for Quicksilver Courier Company in Atlanta, Georgia, USA, fom 1985 go rish 1989 an Vice presidor for Origin International LLC wey dey Atlanta, Georgia, US,A wey bi one flavours an pefume fragrance kompini fom 1990 go rish 1994.

Politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adeleke na komuniti memba an pesin wey dey dash moni an propati wey enta politis for 2001 with e late broda Senator Isiaka Adeleke wey dai for April 2017. E kontest di Osun west 2017 senatorial by-election afta e broda dai an dey kom pik am onda di parti People's Democratic Party.

For July 23 2018, PDP chuz Adeleke as dia kandidate for gofnor as e win Akin Ogunniyi with seven vote.E kontest to di gofnor Alhaji Gboyega Oyetola of APC an Iyiola Omisore of SDP on September 22, 2018. Na dis eleshion wey Independent Electoral Commission (INEC) to sey nobodi win an sey dey go du anoda eleshion for September 27, 2018.Wen dey du anoda eleshion, na APC kandidate Oyetola win an Adeleke tok sey e no gree bikos wayo wayo dey di eleshion.[1]

For March 22, 2019, di eleshion panel wey wey sit for Abuja tok sey na Adeleke win di eleshion bot di kot wey big pass for Naija (Supreme Kot) kom tok sexy na Gboyega Oyetola na im win di 2018 Osun State Governorship Election on Friday, 5 July 2019.

Adeleke kom stil kontest di Governorship Election of Osun State on July 16, 2022 onda di PDP wit APC gofnor Gboyega Oyetola an Adeleke kom win witb402,979 votes an Gboyega Oyetola get 375,077 votes. Di lokal Govament wey Adeleke win na 17 local govament arias an som of Dem na Olorunda, Ede South, Orolu, Osogbo, Odo Otin, Ifelodun, Atakumosa, and Ila.

Pasonal laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adeleke get eight pikin-dem an som of dia nem na B-Red, Ayootola, Goke, Sinarambo, Adenike, Folasade. Davido no bi e pikin bot family memba (e broda Pikin).

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

2.Breaking INEC declares PDP Adeleke winner of Osun election. Punch Newspaper, 17 July 2022. Retrived 3 October 2023