Adebayo Adedeji

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Adebayo Adedeji
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Ancestral homeNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejAdebayo Adedeji Chenj-am
Fest nemAdebayo Chenj-am
Famili nemAdedeji Chenj-am
Wen dem bon am21 December 1930 Chenj-am
Ples wey dem bon amIjebu Ode Chenj-am
Wen e kpai25 April 2018 Chenj-am
Place of deathLagos Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokYoruba Langwej, English langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dumember of the Senate of Nigeria, university teacher, economist, politician Chenj-am
Wu e dey wok forUnited Nations Chenj-am
Wie e go skulJohn F. Kennedy School of Government, University of London Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am
Eye kolordark brown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Awod wey e koletFellow of the African Academy of Sciences Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Adebayo Adedeji (Dem bon am for December 21 1930 an e dai for April 25, 2018) na Naija man wey rid abaut biznes an skul mata. E go skul wel wel an e don bi profeso wen im dey 36 years an dem mek am di oga kpata-kpata wey dey kontrol how dem fit dey mek Naijá beta an du beta beta tins for Naijá from 1971 go rish 1975. Na im kontrol how dem tek stat to dey mek Naijá beta again afta dem don fait war finish. For June 1975 dem mek Adeleke Adedeji one big oga for United Nations for insaid Afrika an e du dis one ontil July 1991. Na Adedeji rait one tin wey dem dey kol Lagos Plan of Action of 1980 an UN an OAU sopot di tin. Wen e kom bak to Naijá, e kom stat one tin wey dem dey kol African Centre for Development and Strategic Studies (ACDESS). No bi govment dey kontrol dis one an dem no dey yuz am mek moni an e opun am so dat pipul go kom dey yuz am len plenti tins abaut Afrika. Dem giv am one big post wey bi Commander of the Federal Republic.

Wen e rish 80 years for December 2010, e stop to de show im face too much for outside an e kom go im vilej for go stay ontil im die for Ijebu-Ode wey dey inside Ogun State for Naija.

Im life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Adebayo Adedeji for December 21 1930 for Ijebu Ode inside Naija.

Adedeji kpai for one evening for April 25 2018 for Lagos afta one big siknes du am. For July, UNECA du somtin for Lagos to tek dey rimemba am.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]