Adams Oshiomole

From Wikipedia
Adams Oshiomhole
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejAdams Aliyu Oshiomhole Chenj-am
Orijina nemAdams Aliyu Oshiomhole Chenj-am
Wen dem bon am4 April 1953 Chenj-am
Ples wey dem bon amEdo State Chenj-am
Fest langwejEdo langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Edo langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dutrade unionist, politician Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Edo State, member of the Senate of Nigeria Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am
E pipulEdo people Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Bifor amOserheimen Osunbor Chenj-am
Replaced byGodwin Obaseki Chenj-am
ReplacesOserheimen Osunbor Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Adams Aliyu Oshiomole(dem bon am on 4 April 1952) na Naija Politishan an forma Nashonal Chairman of di All Progressives Congress[1]. E don sarf bifor as president for Nigeria Labour Congress fom 1999 to 2007 an di executive govnor of State, Nigeria fom 2008 to 2016.

Wen e bi APC Nashonal Chairman, dem komot am for ofis by Abuja Kourt of Appeal on 16 June 2020.

Hau e stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Adams Aliyu Oshiomole on April 4 1952, for Iyamho, wey no far fom Auchi insaid Edo Stet|stet. Na for Muslim haus e tek gro e leta chenj to christian by im waif wey don kpai Clara. E bi Catholic an im Christian nem na Eric. Afta im sekondri edukashon, e get wok wit Arewa Textiles Company, wia dem vote am as union secretary. E kon bi trade union ful time worka in 1975.

For May 2015 e mari yung model wey im nem na Lara Fortes.

Skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 1975 Adams Oshiomole go Ruskin College for Oxford, United Kingdom to stodi industrial relation. In 1989, e go National Institute for policy an strategic studies (NIPSS) pleateu stet|state Nigeria, wey mek am memba of di Nashonal institute (MNI).

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Labor Leader

In 1982, na Adams Oshiomole bi di General Secretary of di Nashonal Union Textile, Garment an Tailoring Workers of Nigeria, union wey get ova 75,000 workas. Wen Nigeria stat democracy bak in 1999 na im bi di president Nashonal Labour Congress an na im dey front wen dem no gree for govment to kari petrol moni go up in Nigeria. Wen president Olusegun Obasanjo stat to dey rul, e folo am tok abaut hau workas moni go up by 25%. Insaid wia plenti pipu gada e tel dem sey na Obasanjo im wan sopot an tel pipu mek dem sopot am tu, Obasanjo enta di sekond time in 2003. Di Textile Union vote for Oshiomole di sekond time as General Secretary, an e kontiniu as president of NLC (Nigeria Labour Congress).

Oshiomole an Obasanjo no tu klose lik bifor bikos Obasanjo dey kari fuel kom fom ouside di kontri, wey kon mek petrol kost wel wel. Oshiomole leed strike an mek oda workas join am dey tok sey dem no gree. Dem arest am, put tear gas for im eye an dey klose union ofis, Obasanjo stil du lor wey mek am hard for NLC to strike. Di NLC tok sey Stet Sekuriti Serfis dem arest Oshiomole on 9 October 2004 but di govmet tok sey no bi so di tin hapun.

Na Oshiomole dey for Labour Afrika workas for tu taims on di Governin Bodi of di International Labour Law (ILO), e sarf for di komitee on hau Association go dey free. Adams na memba of di executive board of di Internashonal Confederation of free Trade Zone.

Politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

In April 2007, Adams Oshiomole kom out as pesin wey wan bi Govnor of Edo state onda di Action Congress Parti, wey Labour parti sef don join dem. Oserheimen Osunbor of di People's Democratic Party (PDP) bi di winna. Labour Parti no gree sey na Oserheimen Osunbor win, dem kon kari dem go kourt bikos of ojoro wey dey insaid. On 20 March 2008, dem kansu Oserheimen Osunbor eleshon an tok sey na Adams Oshiomole of Labour Parti win. On 11 November 2008, fediral Appeal kourt wey dey Benin City stil tok sey na Oshiomole win di eleshon sey Wuruwuru dey insaid hau Osunbor tek win bifor.

Wen dem dey du 2012 Edo Stet Eleshon, na im enta for sekond time, na plenti gap e giv oda wey dey folo am drag for di eleshon. E finish to dey sarf on di 12th of November 2016.

On 23 June 2018, Adams Oshiomole bi di Nashonal Chairman of di All Progressives Party (APC) in Nigeria, na mouth dem uze vote am by parti pipu for Nashonal konvenshon.

On 12 November 2019, dem komot Oshiomole for APC afta 18 Local Govmet Chairman of di parti insaid im stet, Edo pas vote sey dem no blif am lik bifor, But anoda pat for du parti sopot Oshiomole.Dey tok sey na Di pesin wey stat to komot Adams Oshiomole go komot, Di pesin dem tok sey stat am na Godwin Obaseki. On 15 January 2020 APC parti pipu klaim sey bikos dem won komot am for Edo state parti, e no sopos bi di Nashonal Chairman for di parti, kourt folo tok sey mek Oshiomole no go Di parti nashonal secretariat. Fors pipu lik polis, Department of State Service (DSS) an Civil Defens dey to stop am mek e no enta. On 5 March 2020, one federal High Court wey dey Kano tok sey mek Oshiomole stil dey as chairman an di forma jorgmet wey Abuja Federal High Court pas don Kansu. On 26 February, 2023 INEC tok sey na Adams Oshiomole win di senatorial eleshon for Edo North District in Edo. With 107,110 votes, Mr Oshiomole win di bifor bifor senator Francis Alimekhena of di People's Democratic Party (PDP), wey skore 55,344 votes.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Apc-appoints-yobe-gov-head-caretaker-committee. . The Punch Newspaper. Retrived 28 July 2023

2. Vanguatsd Newspaper.Oshiomhole-sworn-apc-national-chairman/. Retrived 27 July 2023