Abdullahi Sule

From Wikipedia
Abdullahi Sule
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejAbdullahi Sule Chenj-am
Orijina nemAbdullahi Sule Chenj-am
Fest nemAbdullahi Chenj-am
Famili nemSule Chenj-am
Wen dem bon am26 December 1959 Chenj-am
Ples wey dem bon amAkwanga Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Hausa langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, businessperson Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Nasarawa State Chenj-am
Wie e go skulIndiana University Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Abdullahi Sule (dem bon am on 26 December 1959) na Naija engineer, biznesman an politishan wey sarf as govnor of Nasarawa Stet sins 2019. Dem vote am as govnor insaid All Progressives Congress (APC).

Hau e tek stat life an edukashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Abdullahi Audi Sule on 26 December 1959, insaid Akwanga - West Developmeta Aria wey kon bi nau Nasarawa Stet. E stat im fest skul for Roman Catholic Mission (RMC) Primari Skul, Gudi Station in 1968. E kon leta go Zang Sekondri Skul in 1974 an leta Govmet Teknika College, Bukuru in 1977. Afta im sekondri edukashon, e kon go Pleateu Stet Polytechnic, in Barkin Ladi in 1980. E kon komot for Nigeria to go Indiana Stet Universiti, Terre Haute, Indiana, United States onda scholarship wia e tek get im Bachelor of Science in Mechanical Technology an masta digre in Industrial Teknologi.

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen e kom Nigeria bak in 1985, Sule sarf as youth corp memba wit Pleateu Untilities Board. E leta join Jos Steel Rolling Mill in 1985 as a produkshon engineer. Wen e kom United States in 1989, e wok for difren kompinis (Lancer Corporation, OEM component an Osyka Corporation an som oda ones) bifor e kom Nigeria in 2000. Wen e kom Nigeria e stat petro biznes wit Sadiq Petroleum Nigeria Limited wey dey Legos an na im bi di managin directo/CEO. Onda im taim as manager im kompini du biznes wit Africa Petroleum (AP) PLC an dem mek am CEO of Africa Petroleum (AP) PLC in 2001. On June 21, upon sey e wan go for du politis in 2018, Dangote Sugar Refinery PLC, mek am dia manager as Group Managing Director (GMD) of di kompini.

Politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

E win di primari to bi Nasarawa Stet Govnor onda ALl Progressibe Congress in 1 October 2018.

On March 10 2019, na im dem anous as govnor wey dem vote for as govnor of Nasarawa Stet insaid Di 2019 Nasarawa Stet gubernashonal eleshon in wey dem du on 29 May 2019. Afta im fest four (4) years as govnor, e stil enta bikos pipu vote for am as govnor in 2023. Na im stil bi govnor of Nasarawa Stet til nau.

Wia dem gada tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. "INEC declares Abdullahi Sule winner Nasarawa guber poll". The Sun Nigeria, 11 March 2019. Retrieved 16 February 2024.

2. "APC 's Abdullahi Sule to battle PDP's Ombugadu in Nasarawa". News Agency of Nigeria (NAN). 1 October 2018. Retrieved 12 April 2023.