Jump to content

Abba Musa Rimi

From Wikipedia
Abba Musa Rimi
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejAbba Musa Rimi Chenj-am
Fest nemAbba Chenj-am
Wen dem bon am28 February 1940 Chenj-am
Ples wey dem bon amRimi Chenj-am
Fest langwejHausa langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Hausa langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Kaduna State Chenj-am
E pipulHausa pipul Chenj-am

Abba Musa Rimi, CON (wey dem bon for 28 Febuari 1940) na one man fom Naija wey pipul chuz mek e bi di pesin wey go rul dem for Kaduna Stet for 1979 wen Naija dey for dia Sekond Ripoblik, dis wan kom mek Rimi bi di pesin wey go dey du laik govno for dat taim wey dem komot Govno Abdulkadir Balarabe Musa as di govno for Jun 23, 1981. Na wen im dey insaid di pati for politis wey dem dey kol People's Redemption Party na im dem tek chuz am as di govno of Kaduna Stet.

Pope John Paul II kom Kaduna for Febuari 1982. Bot som pipul wey dey rul di muslim pipul dat taim no gri kom grit am. Wen di Pope stil dey di epot bifor im kom enta plen go bak to Lagos, e rid one tin wey dem rait giv Rimi an oda pipu wey dey wok for govment sey mek evribodi dey join bodi du tins togeda, weda yu bi muslim or kristen. For Ogost 1982, Rimi yuz gra-gra tok to di Jama'atul Nasril Islam (JNI) sey mek dem si as dem go fit stop di fait-fait wey dey among di smol smol muslim grup wey dia nem na Izala an Darika Muslim grup. For Mach 27 1982, dat taim, Rimi kom stat di IBBI Naija wey stil dey trai wel wel to dey du drink for Not said for Naija.

Afta Jenera Muhammadu Buhari yuz gra-gra bigin rul Naija for Disemba 31 1983, e arest som of di pipul wey dey rul difren difren Stet for Naija. For Mach 28 1985, dem send Rimi go 21 yias for insaid prizin. Dem sey im kari N500,000 dash 96 pipul for di Stet Haus of Asembli wey dey wok for ples wey dem dey join bodi rait evritin wey pipul sopoz du an di one wey dem no sopoz du. Rimi sey im giv dem di moni bikos dem "folo du evritin wey dem sopoz du for dia difren difren eria.

Rimi wok as pesin wi dey hep big big kompini laik UAC, NTC an G.B. OLLIVANT sel dia maket. Afta, e kom bi di oga kpata-kpata for African Circle Pollution Management. Rimi kom stil folo bi pat of di pipul wey get Commander Order of the Niger (CON). Na one waif im mari an dem don bon 7 pikin.

For Oktoba 1998, Rimi kom bi di pesin wey dey advais one soja-man wey bin dey rul Naija wey im nem na Abdulsalam Abubakar for di taim wey Naija chenj go di kain govment wey bi sey wu no bi soja fit rul Naija for di Nigerian Fourth Republic.

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]