Abba Kyari

From Wikipedia

Abba Alhaji Kyari ( dem bon am 17 March 1975) na Naija Polis Ofisa wey bi di deputi komishonal of polis wey dey on sospenshon. Kyari no fit do like polis ofisa for now bikos of e mata wey dey kot. Pipo hakus am sey e join bodi to do bad tins with Ramos Abba.(Hushpuppi. Hushpuppi na yahoo Boyz. Kyari bi memba of IACP ( International Association of Chiefs of Police|Intanashonal Hasosiashon of Shif of Polis]]. Bifor Kyari bikom di IGP-IRT, e don wok for Legos Stet Polis Komand. For Legos Stet Polis Komand, e na Unit Komanda . Dey leta promot Kyari to wok as Ofisa-In-Charge to di polis dipatmet wey no de again, SARS. (Special Anti-Robbery Squard.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 2000 Kyari enta Polis Akademi wey de Wudil, Kano Stet. Kyari finish di Akademi as Hasistat Supa-intedet of Polis tranee . Kyari go do e one year komposiri sarvis for Adamawa Stet Polis Komand . Na Song Polis Divishon e de. Dey leta Kari Kyari mek e bi DCO (Divishonal Krime Ofisa) in Numan Adamawa Stet. E stil wok for Unit Komand 14 PMF Yola.

Kyari kom Legos Stet Polis Komand as 2 IC (sekod in Komand) an leta Ofisa-In- Charge of SARS. Bifor Hushpuppi kess kom up, Kyari don bi di oga patapata of di Inspetor Jeneral of Polis Inteliget Respond Tim in di Nigeria Polis Force wey de Abuja.

E kes wit Hushpuppi[chenj-am | chenj-am for orijin]

On 29 July 2021, Niuz kari am sey Kyari join bodi with di yahoo yahoo boy Hushpuppi to fit yuz wayo kolet $1.1 million from di fonda of one skul wey de Qatari. Hushpuppi now dey for USA prisin as e wan yuz 11 years bikos of di wayo wayo tins wey e don du.

One dokumet wey de kot tok how wahala tek happun bitwin di three yahoo boys Hushpuppi, Juma an Vincent. Dis wahala mek Vincent go link sekret to one pesin wey Hushpuppi an Juma wan yuz wayo for. Dis tin vex Hushpuppi sotey e kom arenj mek dem harest as put Vincent for prisin in Naija. E bi like sey na Kyari Hushpuppi yuz tek du dis tin. Di pepa wey dey kot stil tok how Kyari tek send e bank akaunt to Hushpuppi mek Hushpuppi give am moni for di wok wey e du to harest Vincent. One Naija intanet Niuz-Pepa kol People Gazette tok how Hushpuppi tek arenj mek Kyari kom mit am for Dubai an how Hushpuppi tek yuz moni welkom am wel wel. Kyari tok for e Facebook an e Instagram akaunt sey na liar bi all dis tins wey pipo dey tok about am. Di People's Gazette tok sey United States Department of Justice don tell Kyari sey mek e kom USA kom ansa for dis tin. Di IGP don sospend Kyari from r di polis wok onti di mata finish.

E kokain kes[chenj-am | chenj-am for orijin]

On 14 February 2022, one video sho Kyari dey tok di moni wey e go kolet for 25 Kg of Kokain. E wan give an $61, 400 cash moni. NDLEA hakuss Kyari an six oda polis ofisa sey dia hand dey kokain bizness . Kyari an four oda polis ofisa tok sey na liar bi dat tin wey NDLEA dey tok about dem.